Six players wey fit make transfer moves afta dia waka for Ivory Coast

Clubs around Europe don dey chook eye for di top performers of di 2023 Africa Cup of Nations (Afcon), wia underdogs (teams wey no too strong) don dey dominate.

Plenti players don produce performances wey go sweet scouts belle for di competition wey don dey shock pipo and dey hold for Ivory Coast.

As di knockout stage still dey happun, BBC Sports Africa don torchlight six stars wey be say fit catch European clubs contract.

Four of dem neva play for one of di five top leagues for Africa.

And as three wey dey 22 or younger and as di transfer window dey close on Thursday, e fit no tey before clubs start to toast dem.

Lamine Camara (Metz & Senegal, midfielder)

E bin get African Young Footballer of di Year for December. Di 20 year-old Camara show imself for di senior stage wit two goals and man of di match wen dem win 3-0 against The Gambia for dia opening match.

Dis no be di first time Camara go score two times for one game inside international competition.

E score two wen di West Africans win against Tunisia for di Under-20 Afcon for 2023. E also win for di African Nations Championship last year.

Di box-to-box defender na product of di Senegalese Generation Foot academy wey Sadio Mane bin also go.

E bin dey successful for 84% of im passes before Ivory Coast chase di Terenga Lions comot for di round of 16.

Camara join Metz for February last year and by October e don make name for imself wen e score goal for inside im own half against Monaco for Ligue 1.

Jesus Owono (Alaves & Equatorial Guinea, goalkeeper)

Owono bin win man of di match for two games wey be Equatorial Guinea opening draw wit Nigeria and di 4-0 dem sama Ivory Coast.

Di 2.7 goals e don block na by far di highest by di time wey di National Thunder comot, no oda goalkeeper don block reach two or more by dat time.

Owono keep three clean sheets for four appearances for di 2021 finals and save two penalties for shootout wey make dem win against Mali and allow dem reach quarter-finals.

But di 22 year old neva show for La Liga for di Alaves club wey im dey play for since im debut for February 2022, although im start seven times for two seasons for Copa del Rey.

Owono fit be African next big goalkeeper like legends, Carlos Kameni and Thomas N'Kono for Cameroon and Vincent Enyeama from Nigeria.

Emam Ashour (Al Ahly & Egypt, midfielder)

Ashour bin show ogbonge skill in providing defensive support and bursting forward to boost Egypt attack for dia action packed Group B campaign.

But one concussion bin prevent di man wey pipo dey compare to Pharaohs legend Ahmed Hassan from taking part for dia surprise defeat by DR Congo for di last 16.

Despite say im play substantially fewer minutes dan many of im team-mates, Ashour still finish near di top of di standings among di squad in terms of chances created, passes, tackles won and ball carries, while only top scorer Mostafa Mohamed better im four attempts on target.

Di 25 year old play small for di three times Danish champions wey dem dey call Midtjylland for 2023. E score for im debuts for both Europa League and Superliga. Tori be say dis one happun afta dem move am with €2.6m ($2.8m) from Egyptian side Zamalek.

E come pack to play for Al Ahly last July, but now di question be say any European giant go fit gbab am from di reigning Egyptian champions?

Aboubakary Koita (Sint-Truiden & Mauritania, forward)

Di man wey dey push Mauritania on dia dream runs for finals na Koita.

Di 25 year old burst of speed, explosive wing play and eye for goal bin help di Lions of Chinguetti reach di last 16. Dis na as dem secure dia progress wit di ogbonge first ever win against 2019 Afcon Champions, Algeria.

Koita long range strike wen Angola nack dem 3-2 for group stage go still dey among di goals of di tournament. And e suppose score against Algeria afta ogbonge solo run.

Koita wey dem born for Senegal na regular player for di Belgium top-tier side wey dem dey call Sint-Truiden. Belgium na also wia im spend im youth career, before e spend two years for di former champions Gent.

Gelson Dala (Al Wakrah & Angola, forward)

Dala bin score four times to help Angola to enta di quarter-finals for di first time since 2010. Dis scoreline mean say na only one goal remain for am to reach leading marksman Emilion Nsue.

Afta two goals against Mauritania for group stage, di 27-year-old hit double again come set up goal for di 3-0 win ova Namibia for di last 16.

Only Morocco Achraf Hakimi and Egypt Mohamed Hany don set up chances wey pass di eight Dala don make for im side for dia fourth match for di 2023 Afcon finals.

Dala scoring stats for Angola as young player make Portuguese giants Sporting CP sign am for 2017 but e no enta dia first team and im spend one season for Rio Ave for 2020-21.

For 2022, e join Qatari club Al-Wakrah wia e don dey average pass one goal per game.

Aguibou Camara (Atromitos & Guinea, forward)

Camara alert finish as part of a man-of-di-match display bin give Guinea one vital victory ova The Gambia, and di 22-year-old don feature for evri minute of dia run to di quarter-finals.

E be youth player for Lille and e don gain Champions League qualifying and Europa League experience since e join di Olympiacos for 2021 and now e currently dey loan to fellow Greek Super League side Atromitos.

Di ogbonge attacker wey fit follow play for midfield don play different positions for Guinea for dis competition.

E don already tok say im ready to switch go wing afta Syli National manager Kaba Diawara ask am to switch for di group stage.

Na Ben Miller, Emmanuel Akindubuwa and Isaiah Akinremi compile am.