You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Baltimore Bridge collapse: Wetin we know about di pipo wey die for di accident
Six pipo wey include a father wey born three pikin dey among doz wey don die for di accident wia one container ship bin hit di Baltimore's iconic Francis Scott Key Bridge.
On Tuesday, di US Coast Guard tok say dem conclude say di men don die and dem go suspend dia massive search and rescue effort.
All of dem wey dey affected na members of a crew wey dey work ontop di bridge and dem be citizens of Latin American kontris.
Boats and helicopters don dey take part for di search operation to find di six pipo wey still dey miss. Dem bin pull two pesin out of di water but one dey very serious condition.
Local media report say di six workers na citizens of Mexico, Guatemala, Honduras and El Salvador.
One of di missing workers from El Salvador dey identified as Miguel Luna wey dey work wit Casa, one organisation wey dey provide services to di immigrant community for Baltimore.
"Na husband, a father of three, and im don call Maryland im home for ova 19 years," executive director of Casa, Gustavo Torres tok.
Anoda pesin wey dey confam dead na Maynor Suazo Sandoval, a citizen of Honduras.
End of Di one wey oda users dey read well well
Im broad confam to NBC News say dem inform di family say Maynor dey miss just hours afta di bridge bin collapse.
Day two of recovery efforts dey go on for Baltimore.
Meanwhile, pipo wey sabi swim don recova a data recorder from di ship. Investigators dey hope say im go ansa question of how di ship bin get problem.
Recordings from di responder radio reveal say di police receive alert as dem watch di bridge fall down.
Police don stop traffic and dem bin wan tell di construction workers make dem commot before di ship hit di bridge.
Di six men wey still dey miss na employee of Brawner Builders, a local contractor wey dey carry out maintenance work ontop bridges for Maryland state.
Di Baltimore bridge collapse tori so far
Di landmark Francis Scott Key Bridge for US city of Baltimore collapse afta one ship hit am.
Di crash make most part of di bridge collapse.
Several vehicles bin dey cross di bridge, wey dey more dan 2.6km (1.6 miles) long, wen di container ship collide wit one of im supports.
Six pipo still dey miss inside water and plenty motors still dey inside di river.
Officials say di ship suffer "power issue" and dem issue distress call moments before di crash.
Boats and helicopters bin dey part of one huge search and rescue effort wey dey find di six missing pipo - down from a previous report of seven.
US President Joe Biden say di collapse na terrible accident, and say di federal government go pay money to rebuild di bridge.
Oga Biden wey react to di ship accident as e dey follow tori pipo tok say, di current priority now na di search and rescue of pipo wey dey miss.
Maryland Governor, Wes Moore don declare state of emergency.
Wetin we know about di bridge?
Dem open di Baltimore bridge, wey also dey known as di Key Bridge for 1977, in honour of Francis Scott Key, one 19th Century Maryland poet.
Na im write di words for di US national anthem, di Star Spangled Banner.
Di bridge dey about 8,636 feet (2,632m) long and e cover di Patapsco River and Baltimore harbour.
Di river flow out enta Chesapeake Bay, di largest estuary for US.
Dem describe am as a continuous truss bridge, and im main span of 1,200ft na di third longest of any bridge of im type for di world.
Video footage from di accident bin show as di bridge take collapse afta di container ship, Dali hit one of im pillars.
Di accident happun around 01:30 local time (05:30 GMT) on Tuesday.
Pipo bin dey on top di bridge di time di incident occur. One fact Baltimore Fire Chief James Wallace later confam.
Officials later say those wey dey on top di bridge wen e collapse include contractors wey dey carry out repair works on di bridge.
At 01:50, di first fire department unit land di scene and report complete collapse of di bridge.
Major search and rescue operation still dey go on, as divers dey find victims for di icy waters of di harbour and for di river.
Officials tok say "some cargo or retainers bin dey hang from di bridge", wey create unsafe and unstable conditions, and emergency teams bin dey operate carefully sake of dat.
So far, dem don pull out two pipo from di water, one dey for serious condition and di oda one no get any injury, Oga Wallace tok.
Di water temperature for di harbour currently dey about 9C (48F).
Hypothermia fit occur wen pesin body temperature drop below 35C.
Baltimore fire officials say Sonar don detect vehicles for inside di water.
Wetin we know about di ship?
South Korea Hyundai Heavy Industries bin originally build di Singapore-flagged container ship, Dali, for Greek shipowner Oceanbulk.
Na charter vessel company Synergy Group currently dey operate am and container shipping giant, Maersk currently rent am temporarily, Maersk tok for statement.
Maersk say di container ship bin dey carry cargo for dia customers but no company personnel bin dey on board at di time.
Di ship comot from Baltimore Seagirt Marine Terminal at around 00:24 local time on Tuesday, dey go Colombo, Sri Lanka.
Di speed dey increased normally and e maintain straight route south east along di Patapsco River.
Den for 01:25, Marine Traffic data show say di ship suddenly divert from im straight course and e begin slow down.
Around dis time, video show say all di lights for di exterior part of di ship bin suddenly go off and smoke begin comot from di ship funnel.
E no tey afta, di ship hit di bridge.
One unclassified memo from di US Cybersecurity and Infrastructure Agency wey di BBC US partner, CBS obtain say, di Dali bin "lost propulsion".
Synergy say dem don check di crew, wey all of dem be Indian nationals, plus di two pilots wey dey on board and dem no report any injuries.
Di company say several possible explanations dey for di incident but wit two pilots present, such crash dey unusual.
One shipping expert tell BBC say, engine failure, steering failure or generator blackout fit lead to di accident.
Dis no be di first incident wey di Dali go dey involved in.
As e dey try comot di port of Antwerp, Belgium for 2016, di ship bin scrape im stern along di quay and e damage di hull.
Reports of injuries or spillages bin no dey.
Wetin go be di impact of di bridge collapse?
Di location of di Key Bridge suggest say e go cause major disruption to road traffic for months and even years to come.
E go also affect shipping activity for di port of Baltimore badly.
Di four-lane bridge bin dey part of Interstate 695. Di outer ring road around Baltimore city dey known as di "Baltimore Beltway", and e carry an estimate of 11.5 million vehicles per year.
E go still dey possible to cross Baltimore harbour by tunnel closer to di city, but local authorities don declare "major traffic alert", as dem dey reason significant traffic problems afta di incident.
Di bridge collapse, in particular, go be major problem for lorries wey dey carry dangerous materials, wey fit cross di bridge but dey banned from di alternative tunnel route.
But di incident don cause plenty problem for shipping.
Container shipping expert Lars say na "major disaster" wey go "create significant problems on di US East Coast for US importers and exporters".
E dey estimated say around 800,000 vehicles pass through port for 2023, and dem move a record 1.3 million tons of imported cargo.
However, Oga Jansen add say while some delays and added costs go dey from a global perspective, di incident no go get any significant impact.