You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Key highlights inside de Ghana 2023 budget
Tough days dey ahead for Ghana as govment increase Value Added Tax (VAT) by 2.5% on Thursday.
Dis dey increase VAT from 12.5% to 15%, de latest announcement mean say de prices of goods go go up so far as e get VAT component.
Dis be part of efforts to increase de revenue generation drive of govment. Finance minister, Ken Ofori Atta make dis announcement during de reading of de 2023 budget for parliament today.
As part of efforts to widen de tax net, govment also reduce electronic transactions levy from 1.5% to 1%.
Also, govment remove de transaction threshold of Ghc100 which dey attract e-levy charges.
What dis dey mean be say govment go fit collect e-levy charges on every transaction so far as pesin dey use mobile money/electronic transactions.
Govment announce some expenditure cuts
Finance Minister, Ken Ofori Atta reveal say as part of plans to reduce govment expenditure, dem dey introduce some measures.
- Ban on use of V8 and V6 vehicles except tor cross country travels
- Hiring freeze on civil and public servants No printing of diaries and calendars for 2023
- Freeze on non-critical projects in 2023
Minority say budget go introduce hardship on Ghanaians
According to Finance Minister, Ghana dey work towards securing IMF agreement, debt exchange program den work with local suppliers towards food security in de kontri.
End of Di one wey oda users dey read well well
Minority lawmakers however say govment move de burden on ordinary citizens who go pay more taxes from 2023.
Dem feel say de expenditure cuts wey govment announce be very small in terms of how much dey go into dem.