Di search for Madeleine McCann wey vanish since 2007 wen she be three years don begin again for Portugal

Madeleine McCann
Wetin we call dis foto, Madeleine McCann disappear for 2007, den at di age of three
Read am in 9 mins

Portuguese and German authorities don start a new search for Madeleine McCann for Portugal, nearly two decades after her disappearance.

Madeleine be three years old wen she vanish from one apartment complex for Praia da Luz for di Algarve during one family holiday on 3 May, 2007.

Di British toddler disappearance spark one Europe-wide police investigation, and na one of Europe highest-profile unsolved missing person cases.

On Monday, Portuguese police confirm di search, carrying out warrants by German prosecutors between di resort where Madeleine go missing and where di German investigators prime suspect bn dey stay at di time. Di site cover 21 plots of land according to reports..

Three-year-old Madeleine McCann bin vanish from one Portuguese holiday apartment 18 years ago.

For di later years wey follow, big and costly police operation don take place across most parts of Europe and Madeleine don become one of di most high profile missing pipo.

Madeleine parents, Kate and Gerry, say all dem ever want na to find dia daughter.

Now, German police wey dey investigate her disappearance dey hold fresh searches for Portugal.

Authorities begin new search for Madeleine McCann

On Monday, 2 June, Portuguese police confam di search. German prosecutors wey get search warrant spread across 21 different plots of land - between di resort Madeleine bin miss from and wia di prime suspect for her disappearance bin dey stay at di time.

Di search – wey cover di municipality of Lagos near Praia da Luz for one busy, tourist area - dey due to continue until Friday.

On Tuesday, 3 June, one Portuguese fire engine and four vehicles wey carry German police bin land di search site – wey dey located around 3.5 miles from di resort wia dem last see Madeleine. Dem close all di roads wey lead to di site since Monday.

Di team don clear all di grass around di specific places, dem don begin investigate and also dey look into well-like structures. Dem don also erect one big blue tent for di same area.

About 30 German police officers dey expected to participate for di search.

Madeleine case bin initially dey handled by di Portuguese authorities with di help of di Metropolitan Police.

2007

Di apartment block for Luz for di Algarve, Portugal, wia Madeleine McCann bin miss from.

Wia dis foto come from, PA Media

Wetin we call dis foto, Madeleine bin go missing from dis apartment block for di Ocean Club. Di family apartment dey on di left of di building

On 3 May Madeleine, from Rothley, Leicestershire, bin dey on holiday wit her family for di Ocean Club for Praia da Luz, Portugal.

  • Her parents go dinner wit a group of friends for one restaurant for di complex. Madeleine and her younger brother and sister - twins - stay for di apartment, 100 yards away
  • Di adults bin don devise one rota system wey dem go take dey check on all dia children during di evening
  • Wen e reach di turn of Kate McCann, she discover say her daughter, Madeleine, don disappear
  • Dem alert di police and staff and guests for di complex begin find am until daybreak
  • Authorities bin put border police and airport staff on alert and hundreds of volunteers join efforts to find Madeleine for di following days
Graphic show Praia da Luz holiday complex

On 12 May, di McCanns say dem "no fit describe di pain and despair" dem dey feel.

Portuguese police say dem believe say Madeleine bin dey kidnapped and she still dey alive and for Portugal.

On 26 May, police issue di description of one man wey dem see on di night of Madeleine disappearance, possibly carrying a child.

Police dey search inside long grass and bushes

Wia dis foto come from, PA Media

Wetin we call dis foto, Search happen for di areas around Praia da Luz on di Algarve

For June, one Portuguese police chief admit say vital forensic clues fit don dey destroyed as di scene no dey well protected.

For July, British police send sniffer dogs to assist di investigation, and inspections of McCann apartment and rental car.

By August, e don reach 100 days since Madeleine disappear. Investigating officers tok say dem fit no find her alive.

On 6 September, Portuguese police interview Kate McCann as a witness. On 7 September, detectives make di couple "arguidos" and days later, di McCanns return to UK. Prosecutors later say no new evidence dey to justify re-questioning dem.

Gerry McCann release one video for November wey say im believe say "predator" bin dey watch im family days bifor im daughter disappearance.

2008

Kate and Gerry McCann leave church for Rothley, Leicestershire, afta one service to mark di first anniversary of dia daughter disappearance

Wia dis foto come from, PA Media

Wetin we call dis foto, Kate and Gerry McCann leave church afta one service to mark di first anniversary of dia daughter disappearance

On 20 January di McCanns release sketches of one suspect, based on di description of one British holidaymaker wey say im see one "creepy man" for di resort.

For April, Portuguese police fly go UK to sit in on interviews wey Leicestershire Police get wit McCanns and di friends dem bin have dinner wit on di night Madeleine disappear.

On 3 May, one year since di disappearance, Kate McCann say make pipo "pray like mad" for her little girl.

By July, Portuguese police say dem don submit dia final report on di case. Weeks later, authorities pause dia investigation and lift di "arguido" status of di McCanns.

2009 and 2010

One poster wey Find Madeleine Campaign release show Madeleine McCann as she be at di age of three, and how she fit look at di age of six

Wia dis foto come from, Find Madeleine Campaign

Wetin we call dis foto, Dem release foto of how Madeleine fit look at six

On 3 November, authorities release new images of how Madeleine fit look now.

For March 2010, di McCanns criticise di release of Portuguese police files wey pipo neva see bifor to British newspapers - di file get details of possible sightings of Madeleine.

One month later, for April, Gerry McCann say dem dey "frustrated" say di police for Portugal and UK don stop to dey actively look for im daughter "for a very long time".

For November, di couple sign one publishing deal to write book about Madeleine disappearance.

2011

Kate and Gerry McCann for one event to launch dia book, Madeleine

Wia dis foto come from, PA Media

Dem release McCanns book, Madeleine, for May.

Prime Minister David Cameron ask di Metropolitan Police to help investigate. One two-year review follows.

2012

How Madeleine fit look age nine

Wia dis foto come from, Teri Blythe

Det Ch Insp Andy Redwood, di detective wey dey lead di UK review of Madeleine disappearance, tell one April broadcast of di BBC Panorama say im team dey "work to bring closure to di case".

Dem release one computer-generated image of wetin Madeleine fit look like at di age of nine, one day bifor Portuguese authorities tok say dem no dey reopen dia investigation.

2013

E-fits wey police wey dey investigate Madeleine McCann disappearance release.

Wia dis foto come from, PA Media

Wetin we call dis foto, Dis e-fit images feature for one BBC Crimewatch appeal

For May, UK detectives wey dey review di case tok say dem don identify "a number of persons of interest".

By July, Scotland Yard announce say dem get "new evidence and new witnesses" in di case and dem open formal investigation.

By October, Scotland Yard detectives say dem don identify 41 potential suspects.

One BBC Crimewatch appeal feature e-fit images of one man wey dem see carry one blond-haired child of three or four for Praia da Luz at about di time Madeleine bin go missing.

Portuguese police reopen dia investigation - to run alongside Scotland Yard - citing "new lines of inquiry".

2014

British police dey search for Madeleine McCann

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Met Police officers search scrubland near wia Madeleine vanish for 2014

For January, British detectives fly go Portugal for di middle of claims say dem dey plan to make arrests.

For June, dem carry out searches for Praia da Luz, including one area of scrubland wey dey for di south-west of di Ocean Club complex. Nothing of interest come out of di search.

One month later, for July, police interrogate four suspects but no new developments come out.

2015-19

Madeleine McCann
Wetin we call dis foto, Madeleine McCann be three wen she miss for 2007

For September 2015, di British government disclose say di investigation don cost dem more dan £10m.

For April 2017, dem rule out di four official suspects wey police investigate but senior officers say dem dey pursue a "significant line of inquiry".

For June 2019, UK government tok say dem go fund di Met Police inquiry, wey start for 2011, until March 2020.

2020

Map of di scene

One year later, for June 2020, police reveal say dem don identify one 43-year-old German prisoner - wey German media name as Christian B - as suspect.

Di McCanns thank police, and say: "All we ever want na to find her, uncover di truth and bring those responsible to justice.

"We no go ever give up hope of finding Madeleine alive, but whatever di outcome fit be, we need to know as we need to find peace."

German investigators label am as murder inquiry and say dem dey assume say Madeleine don die.

UK Metropolitan Police tok say dem don receive more dan 270 calls and emails since dem launch new appeal for information on Wednesday.

2022

Madeleine McCann

Wia dis foto come from, PA Media

For April 2022, Portuguese prosecutors wey dey torchlight di case declare one German man as official suspect.

Dem make Christian Brückner, wey be 45 den, as "arguido", although Portuguese authorities no formally reveal di suspect name.

2023

Scene near di reservoir for Portugal

Wia dis foto come from, SOLARPIX

Di McCann family mark di 16th anniversary of Madeleine disappearance on 3 May 2023, dem say dem "miss her well-well" and dem dey "wait for breakthrough".

Later dat month, one Portuguese news website report say dem don seal off one area near one reservoir, about 30 miles (48km) from Praia da Luz. tok say dem don begin search di Arade dam on 23 May, but di searchend afta three days.

For October, Portuguese police tok sorry to di McCanns, dem say di investigation into Madeleine disappearance no dey properly handled, at di time, dem no dey too give attention to missing children and her parents position as foreigners for environment dem no understand no dey appreciated.

2025

For April,UK government approve more dan £100,000 in additional funding for Scotland Yard detectives wey dey investigate Madeleine disappearance.

One month later for May, di McCann family mark 18 years since her disappearance, dem say dia "determination to leave no stone unturned no dey shake".

For di same month, authorities reveal say dem go soon release di chief suspect for Madeleine disappearance Christian Brückner from prison for Germany.

Bruckner dey serve sentence on top accuse say e sexually assault one elderly American woman for Praia da Luz for 2005. Im lawyer say dem go release am for September or, if e no pay fine, early 2026.

On 3 June, fresh searches wey German police lead start for Portugal, between Praia da Luz and Lagos. Di areas dem dey search dey close to one ramshackle wia Brückner bin dey live at di time of Madeleine disappearance.

One map wey show Praia da Luz and Lagos