You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Spain come from behind to beat France as dem cruise into Euro 2024 final
Spain don qualify for di 2024 Euro final afta dem sama France 2-1 for di semifinals.
Goals from 16-year-old Lamine Yamal and Dani Olmo dey enough afta Kolo Muani don score first for France.
Luis De La Fuente im side dominate di game in terms of possession and chances for di 90 minutes.
Despite dia early goal, France neva fit to take dia chances late for dis game, as Mbappe, Dembele and Griezmann don waste dia chances.
In di end, anoda masterclass by di Spain youngsters Lamine Yamal and Nico Williams carry La Roja enta di final.
Di headlines go be di goal wia di Barcelona youngster Yamal don score from outsdie di box.
Wit dat goal, Yamal become di youngest player to score goal for di Euros.
Di 16-year-old also get 3 assists so far for di tournament.
End of Di one wey oda users dey read well well
Despite all di accolades for Yamal, Dani Olmo wia enta di last game for Spain vs Germany wia im score and grab assist, don do am again wit anoda fine display.
Olmo grab di winning goal inside di first half and since dat time, France neva fit equalise.
Spain vs France match highlights
FULLTIME
France don exit di competition. Spain now go wait to see whether dem go face England or Netherlands for di finals.
Referee don blow whistle to end di game. Spain beat France to qualify for di finals. 16 year-old Lamine Yamal na di star of di game as im set record as di youngest player to score and grab three assists for di Euros.
96" Spain don win freekick wia dem dey delay to take am.
95" CHAAANCE! Griezmann head di ball towards goal but di header dey high wey e drop on top of di Spain box.
94" Spain dey try to keep possession but France don dey press dem to try and force di equalizer.
92" Spain wan make two more substitutions. Goalscorer Yamal don dey comot. Di youngest goalscorer for di Euros dey replaced by Ferran Torres and Zubimendi dey replace Nico Williams.
90" Lamin Yamal don get yellow card as im commit professional foul to stop di France counterattack.
90" Dem don add 5 minutes.
89" Chance for Spain! Dem pass pass di ball in front of di France box bifor Cucurella try to cross di ball but im go corner.
88" Spain don win freekick as Camavinga foul Cucurella. Yellow card for di real madrid midfielder.
87" As France try to build quick attack, Upamecano play one hard pass wia beat Kounde for throw ball.
86" Mikel Oyarzabal commit foul against Camavinga. Freekick
85" CHAAAANCE! Mbappe gat brilliant chance afta di PSG man beat Vivian wey im enta di box, but im smash dat ball ova di bar. Big big chance.
84" Game don restart as Laporte continue to dey bleed.
83" Laporte don dey receive treatment for di park.
82" Griezmann dey offsidede. Bifor dat Giroud don crash wit Laporte. Di striker take im shoulder block di defender wia im dey ground.
80" CHAAAANCE! Lamine Yamal try try to shoot anoda long range ball in front of di area but dis time di ball go wide.
79" saliba don hack down Lamine Yamal inside di Spain area bifor France gat di ball. Nacho block Barcola im cross for corner.
78" France don carry dia record goalscorer Olivier Giroud enta di game to try and find dat goal. Im replace Dembele.
77" France go feel say dem dey run out of time to score di equalizer. but dem gat 13 + minutes to do dat
76" Mikel Oyarzabal don replace Morata wia Merino replace goalscorer Dani Olmo
75" CHAAAANCE! France don create one chance afta Dembele cross di ball for Theo Hernandez but im shot go wide.
74" Di past few seconds to one minute na Spain wia dey pass di ball around.
72" Dembele don win anoda corner wia im cross enta di area but Spain break for di counter.
71" Slowly France bin try to pepper di Spain area - whenever dem try, dem no fit to penetrate.
70" France create chance wit Barcola inside di box wia im cross di ball into nobody in particular.
69" Nico pass ball to Cucurella as im dey rush enta di French box but di chelsea player im cross dey blocked.
69" Spain dey prepare to bring anoda player inside di game
68" Dembele try to take control of di ball wia im fould Morata in front of di Spain box.
67" Spain now dey pass pass di ball around to keep dia control but dem lose possession to France.
65" Dembele tink say im win freekick afta three Spain players block am in front of dia area but referee say e neva be foul.
64" France pick di ball wit Mbappe, di french captain beat im marker wia im lay back pass to Theo Hernandez, but im no fit reach di ball.
63" Upamecano almost make mistake for defense wia Nico Williams dey pounce, but im goalkeeper Maignan don bail am out
62" Dembele kick di corner wia Upamecano head am for di backpost - but di header go ova.
61" France don win corner but Kante, Rabiot and Kolo Muani go comot di park bifor dat corner.
60" Three changes for France - Barcola, Griezmann and Camavinga all dey enta di game as le bleus dey try put pressure to get a goal.
59" As France dey push for di Spain area, Tchouameni don chop yellow card for foul on Morata afta France cross di ball into di box.
58" Morata win freekick bifor Nico Williams carry ball pass Kounde in legs.
Game don stop as some pitch invaders don enta di park.
56" Spain don make one change wit Vivian - to replace Jesus Navas.
55" Williams try to win di footrace wit Kounde but di frenchman don win am wia im pass di ball to im keeper. At di oda end, Mbappe get chance but im shot dey weak wia goalkeeper Simon don gather am.
54" France dey try create sometin for di Spain area. Di ball end up wit Yamal wia im win goalkick for di far right corner of di Spain area.
53"From di corner, Tchouameni head di ball straight to Simon.
52" CHANCE! Spain lose possession for dia area wia Kounde carry di ball enta di area, but im cross dey blocked wia im go ova for corner.
51" France now dey pepper di Spain area wit Mbappe cross, Dembele take one touch bifor im try to cross back. Di cross dey poor.
50" Nico try to beat Kounde wit some skills but im lose possession bifor Kante try to run wit di ball into di Spain area.
49" CHANCE. cucurella cross one ball inside di area but Saliba don block am bifor im go reach Morata.
49" From dat throw, Spain try to enta di France area but Cucurella carry di ball come back
48" Spain don force Adrien Rabiot to concede throw ball for di far side.
Di French keeper Maignan don dey struggle afta im comot from im goal come clear one ball, but im go carry on.
46" Dembele don cross one ball into di Spain area wia Unai Simon catch am.
46" Nico Williams almot reach one Morata pass wia goalkeeper Maignan comot come clear bi ball.
Spain begin dis half but Jesus Navas play on high back pass wia Nacho struggle to clear.
No changes for both teams so far.
Referee don blow whistle for di second half to begin.
Big 45 minutes we gat for our hands.
Players don dey emerge for di second half as France look to grab equalizer - wey Spain go hope to extend dia lead.
HALF TIME
Referee don blow whistle for halftime between Spain 2 - 1 France.
46" Kolo Muani don foul Nacho, Di Spanish players don dey call for yellow card but di ref say na just foul.
45" Saliba don foul Dani Olmo as im try to spin to take Yamal im pass. Freekick.
45" Cucurella don win freekick inside di Spain area afta Dembele foul am.
44" As halftime don dey approach, dem add 2 minutes.
43" Dembele im cross no trouble di Spain defense.
43" France get freekick for di Spain right hand side. Dembele go take am.
Uefa confam say di second Spain goal na Dani Olmo im goal as im shot dey enta di goal bifor Kounde touch am intoi im own net.
40" Maignan don save di corner wia im begin to pass from di back for France.
39" Dembele take di freekick long - Jesus Navas clear am bifore Spain break for di counter. Nico Williams carry di ball take run enta di France area wit Morata and Yamal. Im pass tio Yamal but Hernandez block im shot for corner.
38" From di corner, Laporte don head am away but di ball come back into di area bifor Cucurella commit anoda foul against Dembele for di edge of di Spain box.
37" France don win corner afta Cucurella and Williams give Dembele pressure for di Spain left side.
36" Nico Williams take corner wia France clear, bifor Yamal play one wayward cross wia beat everibodi bifor im go ova for goalkick.
35" CHAAANCE! Fabian Ruiz take one shot from Yamal pass, but im deflect for corner.
34" Theo Hernandez don foul Yamin Yamal for touchline wia refree blow whistle for freekick.
33" France now begin to dey pass pass di ball for dia area bifor Dembele cross di ball, but Theo Hernandez misjudge am wia im go out.
30" Spain break afta dat Mbappe ball don spoil wia Nico Williams enta di box, but Morata no fit to take advantage of im backheel - di chance don miss.
29" Spain don dey pass pass di ball for dia half bifor dem try to go forward but Mbappe collect di ball wia im don dey run at di Spain defenderrs.
28" Morata don foul Kounde in front of di Spain area. Freekick.
27" Uefa don take dat goal as own goal by Joules Kounde.
25" GOOOAALLLLL! Dani Olmo don score four minutes afta Yamal im goal. Dani Olmo wit great skill to beat im marker bifor im score. Spain 2 - 1 France.
22" Spain try to build on top of dia equalizer but di ball into di box beat everybody.
Wit dat goal, Yamal don become di youngest player to score for di Euro tournament
20" GOOOOOOAAAAAL! 16-year-old Yamin Yamal don bend di ball into di net from outside di box. Ibcredible goal 1-1
19" Spain dey try build from di back but so far e no dey work.
18" CHAAANCE! Mbappe gat chance to shoot but di ball hit Nacho wia im bounce inside di area bifor Spain clear.
17" France bin dey try control di game wit dia 1-0 lead but Spain no dey gree.
15" Mbappe take di freekick but im no trouble di Spain defense.
13" Jesus Navas don foul Adrien Rabiot wey im get yellow card. Freekick not far from di Spain box.
11" Morata no fit connect to one cross into di box.
11" Spain try to create sometin but dem dey try to pass di ball into di net - France defenders dey steady for di back
Dat goal na di first open play goal from France for dis tournament.
10" France don shock Spain wit dat goal as dem for try to respond.
8" GOOOOOAAAAAAL! France don score from a Kolo Muani header. Mbappe grab di assist wit one fine cross
7" France dey try to create somethin wit passes bifor Nacho hack down Kolo Muani.
6"CHANCE for France but 38-year-old Jesus Navas step across to clear one true ball from Kolo Muani.
4" Spain don dey try to get possess di ball unti Nico cross di ball into di area - Yamal cross di ball back but Ruiz head am ova. Di CHANCE don vanish.
3" Nico Williams fail to capitalize for di counter as im lose possession for di middle.
3" France don win freekick inside di center area as Yamal foul Theo Hernandez, but from di freekick, nothing happun.
2" Early chance for Spain - di chance begin wit Yamal for di left side of di France area bifor im pass to Ruiz for di far side, but di PSG man im cross dey too hard.
Di winner of dis game gi meet di winner of di oda semifinal game between England and Netherlands
1" Early pressure from Spain don win dem throw ball for di center area.
1" France be di first team to pass di ball from di center for dis match wia di whole world don dey watch.
1" Referee don blow whistle for di game to start
Both teams comot for park wia dem don sing dia anthems.
Welcome to our live text coverage of dis ogbonge semi final game for dis Euros.