'Autopsy confam Davido son die from drowning' – Police

Di Lagos state police command on Saturday don reveal di result of di autopsy wey dem dey on di deadbodi of Ifeanyi Adeleke, son of Davido and im fiancée, Chioma Rowland, do come out.

According to di toktok pesin for di police command Benjamin Hundeyin, di cause of death of Ifeanyi death na ''drowning''.

E also tell BBC Pidgin for telephone interview say dem don transfer di two suspects wey dey dia custody go di state criminial investigation department (SCID) Yaba area of di state for further investigate.

Di three year old Ifeanyi Adeleke, wey be di fisrt son of di popular Nigerian Afrobeat star, Davido and Chioma die on di night of 31 October, for di musician house wey dey for Banana Island area of di state.

Ifeanyi death wey attract tributes from plenti ogbonge pipo around di world also raise concern over safety of pikin dem around siwmming pool.

'We no arrest Eniola Badmus' - police

Hundeyin also tell BBC Pidgin say e no true say dem arrest nollywood actress Eniola Badmus over di death of Davido son death.

Tori begin fly up and down early mor-mor on Saturday, 5 November on local blogs and social media plaftorms about di rumoured arrest.

But di police toktok pesin say ''dat tori na false. Nothing like dat happun''.

Di thing be say Eniola and Davido be friends wey dey always show affection to each oda ontop social media.

She be one of di few pipo wey pipo believe first drop hint about Ifeanyi death ontop social media though she later delete di post ontop her Istagram page - dis make pipo vex and drag her questioning di kain friemndship she share wit di pop star.

She never comot to tok anything.

Eniola Badmus biography

Eniola Badmus aka Senator Badoski na Nigerian actress and movie prodcuer.

Dem bin born am for Ijebu Ode for Ogun state, southwest Nigeria.

Di ogbonge actress na graduate of Theatre Arts from di Univrersity of Ibadan and also collect Masters degree from di Lagos state university wia she bin study economics.

She begin act for 2000 but her shine begin shine around 2008 when she start to dey feature for Yoruba movies wella.

She don act inside plenti movies and she also get some under her name as producer.

Recently, di actress wey formerly be plus size surprise her fans with her new phyisical apprearance as deh don lose a signifcant amount of weight under one year.