You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Waec don release 2025 results
Di West African Examinations Council (Waec) don release results of candidates wey sidon for di 2025 West African Senior School Certificate Examination (WASSCE).
Dem confam am inside statement dem publish on Monday 4 August 2025.
"Di West African Examinations Council dey pleased to inform candidates wey sit WASSCE for School Candidates, 2025 say di result don officially dey released today, Monday, August 4, 2025," Waec write for X.
Earlier on, Waec bin don deny report say dem cancel all di papers for di WASSCE 2025 exam.
Waec say dem see news wia one supposed press statement wey dey fly up and down for social media dey claim say di Federal Ministry of Education don cancel di examination sake of "examination malpractice, leaked exam papers and unauthorised spread of exam materials".
Di WASSCE 2025 papers bin take place few months back and during dat time, some conversation about malpractice bin come up.
For May 2025, students write di English Language paper 2 essay exam for di Waec examination late into di night on Wednesday 28 May, 2025 wia parents say dem no happy wit dat kain development.
Dat particular paper suppose take place for afternoon but na for late for night dem write di paper.
For July Waec bin dismiss one press statement wey allege say di council bin cancel di result of candidates wey sit for di 2025 examination.
Di statement bin claim say Waec don cancel di result becos of massive examination malpractice and di digital dissemination of examination materials but di council deny di information.
"Though we no fit ascertain di source of di information, di council dey certain say di false claim na mischief-makers wey wan bring di council to disrepute and cause di confusion and panic among candidates wey sit for di examination," di statement tok
How to check Waec result?
To check your Waec result, visit www.waecdirect.org and log in.
You go need Waec scratch card to check your result.
Login to WAEC Result Checker Website www.waecdirect.org.
Enter your Examination Number
Select Examination Type e.g May/June
Select Exams Year e.g 2025
Click on Check Result.
Who dey mark Waec results
No be Waec dey mark students examination paper, na examiners Waec dey appoint to mark di scripts.
Dis examiners na sabi pipo for di education sector wey sabi classroom work well-well.
To ensure say mago-mago no dey for di grading system, Waec dey set up committee of experts wey go come up wit di marking guide.
Dem dey organise di examiners into small groups and each of dem go dey supervised by one highly experienced examiner wey be di Team Leader.
Na di Team Leader dey check and vet di group members marking progressively to make sure say dem dey follow di guidelines. Dem kon also get Chief Examiner.
Wen dem don mark finish, Waec go still employ anoda group of pipo - dose ones dem dey call dem Checkers.
Wetin to know about Waec?
Di West African Examination Council na international exam for senior secondary school student wey dey happun evri year.
Kontris wey dey write Waec na Nigeria, Ghana, Gambia, Liberia, and Sierra Leone.
Na for 1952 dem establish am. According to information on top dia website, di vision of di West African Examinations Council na to be world-class examining body wey dey add value to di educational goals of im stakeholders.
Waec na West Africa ogbonge examining board wey dey established by law.
Dia work na to set, conduct di examinations and to award certificates wey dey comparable to dat of equivalent examining authorities internationally for di English-speaking West African kontris.