'Tinubu no suppose use im executive power' - Supreme Court reaffirm death sentence for Maryam Sanda

Read am in 3 mins

Di Supreme Court don uphold di death sentence wey dem give Maryam Sanda, di daughter-in-law of former PDP Chairman, for di case of culpable homicide.

For one split judgment of four to one, five justices for di apex court restate say di order wey sentence her to death by hanging still stand.

Di court reject all di arguments wey she bring to cancel her conviction and throway her appeal, tok say e no get merit.

For di main judgment wey Justice Moore Adumein deliver, di Supreme Court say di prosecution prove di case against her well-well beyond reasonable doubt.

Di court also tok say di earlier decision by di Court of Appeal, wey uphold di trial court judgment, correct and nothing dey wrong with am.

Di Supreme Court add say President Tinubu no suppose use im executive power to grant pardon for a case of culpable homicide when appeal still dey ongoing.

Background of Maryam Sanda prosecution

For October, di Office of di President release list of pipo wey President Bola Tinubu grant pardon and clemency.

One of di names on top di list na Maryam Sanda, wey court sentence to death in 2020 for stabbing her husband to death.

Di decision cause plenty debate for social media as many Nigerians criticize Tinubu for pardoning her.

But after di matter cause controversy, di presidency tok say di pardon come sake of her remorse and good behaviour for prison.

Di tok-tok wey pipo do for Nigeria make President Tinubu use im executive power reduce her total sentence to 12 years, even say she bin spend about six years and eight months for Suleja prison.

Dem bin arrest Maryam for November 2017 say she stab her husband, Bilyaminu Bello to death.

Bilyaminu na di pikin of one former chairman of Nigeria main opposition party, di People's Democratic Party (PDP), Haliru Bello.

Maryam Sanda bin marry Bilyaminu Bello, di son of di former PDP Chairman, Haliru Bello but for 2017, gbege come start afta she claim say she find naked woman picture for her husband phone. She come tell her husband make e divorce her if not she go cut im penis.

For January 2020 one Abuja High Court don sentence Maryam Sanda to death by hanging afta dem find her guilty for di murder of her husband, Bilyaminu Bello.

Justice Halilu Yusuf of di FCT High Court tok say all di evidence wey dem present point to di fact say she dey guilty of homicide.

Justice Yusuf say 'blood for blood' and dat anybodi wey kill anoda human being, im sef deserve to die.

E explain say di way wey husband and wife dey kill each oda for di kontri don too much and dis case suppose serve as warning to many for di society.

E say make dem cari Maryam go Suleja Correctional centre pending wen she go finish all her appeal.