Unizik react to student wey allegedly attack lecturer

Read am in 3 mins

Di authorities of Nnamdi Azikiwe University say dem dey investigate di incident between one female student wey allegedly attack one lecturer.

Tok-tok pesin for di university, Njelita Louis, say dem dey take di incident seriously and urge all di concerned parties and members of di public to dey calm.

Dem tok dis inside statement wey dem release about di mata.

For inside viral video, Goddy Mbakwe Precious allegedly attack Dr Chukwudi Okoye afta im interrupt her wen she dey record her video for corridor inside di school.

Dis incident happun on Tuesday 11 February for south east part of Nigeria.

Wahala start wen Dr Okoye wey be lecturer tap Precious for body and say 'excuse me' as im dey waka pass during her recording.

Precious pause den look Dr Okoye one kain bifor she vex tell pesin say ''imagine im just hit me''.

Afta she tok dat tin na im di allege assault happun, di student confront di lecturer about di incident.

Video show di student dey allegedly fight and tear di right side of the lecturer brown native clothes.

She also been dey hold di lecturer, wey bin look calm throughout di incident.

UNIZIK say dem go take appropriate actions and sanctions go dey based on di outcome of di investigation.

"In line wit our core values of discipline, self-reliance, and excellence, and in adherence to di principles of fair hearing, equity, and justice, di Acting Vice-Chancellor, Joseph I. Ikechebelu, don order a full-scale, transparent, and unbiased investigation into di matter," na wetin di statement read .

"Nnamdi Azikiwe University still remain institution of learning wey dey uphold high moral and ethical standards. We no get place for indiscipline, misconduct, or any form of unacceptable behaviour within our community," di statement add.

Fotos online also reveal deep bite marks for im hand.

According to information from di school authorities, dem say di student identified as Goddy Precious na 3rd year student for department of history and international studies.

Although dem no tok how long di investigation go last but dem say dem go give updates wen necessary.

'My brother na di calmest and di most humble pesin you go ever meet'

Di lecturer sister tell Daddy Freeze for interview say dis incident involving her brother dey veri shameful.

She open up about her brother personality. ''Wetin you see for dat video na my brother, na di calmest and di most humble pesin you go ever meet.

''E dey painful to come online to see all dis comments, most pipo dey try to defend di girl," she tok.

''Pipo dey tok say weda im don toast di girl bifor. Im wife na magistrate. Im first daughter na student of di university."

Di sister say she don tok to her brother ova 10 times on top dis mata and im tell her wetin happun.

Her broda tell her why im bin stop. According to her im bin wan know weda di girl na im student.

Becos wia di incident happun dey close to im office but wen im go close to her im no recognise her.

As di girl dey do video, di lecturer pass and show for di video.

She say her brother tell di student to delete di video, di girl begin hala, from den di mata just escalate.

She say im bin no really understand wetin dey happun, bifor im know wetin dey happun di girl begin "beat am", she tok.