Inside Gaza hospital afta Rafah ‘massacre’ strike

Inside one hospital as medics desperately try to deal wit di pipo wey dey injured, afta Israel bomb one displaced pipo camp west of Rafah.

Di bomb near one UN facility forTal al-Sultan wia e kill women, di elderly and children. Locals say e hit one zone wey dem tell dem say dey safe.

Di strike dey come afta International Court of Justice insist make Israel stop dia operations for Rafah.