Which kontris don qualify for Euro 2024?

We don dey enta di final stage of qualification for next summer European Championship.

Na two teams go qualify from each group, dem go fill 20 of di 24 spaces for next summer tournament.

Di host kontri Germany, don qualify automatically, while di remaining three spots dem go decide am through play-offs, na 12 teams go participate for dis round.

And to qualify for dis round dem go choose di teams based on dia performance for di 2022-23 Nations League.

On Friday, Belgium, France and Portugal become di first three kontris to progress through di qualifying phase, meanwhile on Sunday, Scotland, Spain and Turkey join dem.

BBC Sport torchlight how di qualifiers dey go and di key fixtures wey di come.

Scotland confam dia qualification afta Spain 1-0 win for Norway on Sunday, victory wey also secure Spain place for di finals.

Erling Haaland Norway now dey in big danger of elimination, dem get only slim chance to qualify via di play-offs option.

England also dey top dia group, but dia 100% winning record end on 9 September afta dem bin play 1-1 draw wit Ukraine for Poland.

Gareth Southgate team get a three-point lead ova Ukraine and Italy, although Italy get a game in hand.

England go host di European champions Italy on Tuesday, di Three Lions know say if dem win dem go secure qualification and top spot.

Wit dia new manager Luciano Spalletti in charge, Italy bin play draw wit North Macedonia - di team wey deny dem a place for last year World Cup - on 9 September. But Italy don move back into second wit wins against Ukraine and Malta.

Wales don move into second place for Group D wit dia win at home to Croatia on Sunday, as Turkey secure dia qualification afta dem knack Latvia.

Wales go play Armenia next away on 18 November, before one last match at home to Turkey three days later.

If Wales no finish for di top two, dem still fit get another chance to qualify as dem dey likely to go enta di play-offs because of dia results for di Nations League.

Northern Ireland hopes of qualifying from Group H don end pata-pata.

Losses for Slovenia and Kazakhstan during di most recent international break don leave dem wit just six points from seven games and 10 points behind di top two wey be Slovenia and Denmark.

Di Republic of Ireland don win only once for di six games dem play for Group B, dia 2-0 home loss to Greece on Friday confam say dem no go finish for di top two.

Dia only hope for qualification, and na slim one, na say dem fit take part for di play-offs because of dia Nations League performance, but dem need results to go dia way and as tins be dem dey set to miss out and no go reach Euro 2024.

France maintain dia 100% record wit dia 2-1 victory ova Netherlands, dat result see dem confam dia qualifications for di finals.

Greece win take dem above di Dutch, wey get a game in hand, di two nations go meet for Athens on Monday. A four-goal Greece win go carry dem to Germany as dem go get better head-to-head record against diNetherlands if dem finish on di same points.

Group leaders Albania only need to win one of dia last two matches to qualify for di European Championship for only di second time afta dem beat Czech Republic 3-0 on Thursday.

Czech Republic return to second position wit 1-0 home ova Faroe Islands on Sunday.

Belgium, wey bin reach quarter-final for di past two European Championships, don qualify for next year tournament thanks to dia 3-2 win away against second-placed Austria.

Di Austrians go join Belgium for Germany if dem beat Azerbaijan on Monday.

Hungary and Serbia na di standout sides for Group G, although Hungary get advantage afta dem beat dem twice.

Draw for Lithuania scata third-placed Montenegro plans, but a t win ova Bulgaria means say dem still dey in contention.

Montenegro trip to Serbia on Tuesday dey very important.

Romania return to di top of dia group wit comfortable win against Andorra on Sunday.

Israel fixtures at home to Switzerland and away to Kosovo Uefa don postpone am sake of di security situation for di kontri.

Portugal show dia power for dia group dia 3-2 win ova Slovakia na dia seventh win in seven games, wey see dem secure dia place for Euro 2024.

Slovakia, Luxembourg, Bosnia-Herzegovina and Iceland all dey fight am out for di runners-up place. On Monday, Bosnia-Herzegovina go play Portugal for dia home, Iceland go host bottom of di group Liechtenstein, and Luxembourg go climb to second if dem win at home against Slovakia.

Each nation play 10 matches for dis group, qualification for second place go, go down to di final two rounds for November.