You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Who be di candidates wey dey run for Anambra governorship election?
Di race for who go be di next govnor of Anambra state for southeast Nigeria don start.
Several political parties conduct dia govnorship primaries on Saturday wia dem announce dia candidates.
Independent National Electoral Commission (Inec) set 10 April as deadline for all political parties to conduct dia govnorship primaries.
Anambra govnorship election go take place on November 8, 2025.
Dis na eviritin you need to know about all di candidates wey don emerge.
Charles Soludo (APGA)
Anambra state Govnor Charles Soludo go run for second term for office afta im win di All Progressives Grand Alliance Party ticket.
Govnor Soludo, stand as di sole candidate of APGA during di party convention for di forthcoming gubernatorial election .
3,260 accredited delegates take part for APGA convention on Saturday.
Out of which 3,175 cast dia votes. Of those, 3,168 dey valid, wit only four invalid entries—each one of di valid votes go to Soludo.
Chief Nwaegbo Uche, chairman of di electoral committee, officially declare Soludo returned as di party candidate.
Di votes come from —Aguata, Anambra East, Anambra West, Anaocha, Awka North, Awka South, Ayamelum, Dunukofia, Ekwusigo, Idemili North, Idemili South, Ihiala, Njikoka, Nnewi North, Nnewi South, Ogbaru, Onitsha North, Onitsha South, Orumba North, Orumba South, and Oyi.
Governor Soludo for im acceptance speech, pay homage to di founding spirit of APGA, e describe am as di first registered progressive party for Nigeria, dating back to 2002.
"Anambra na APGA, and APGA is Anambra," im tok as im supporters hail.
Governor Soludo list im administration accomplishments.
Im cite di recruitment of ova 8,115 teachers and public servants from across di kontri as part of im push to revamp human capital development.
Soludo torchlight dia gains for security and law enforcement, e tok how dem dey scata criminal hideouts and gradually dey restore peace .
Im speak passionately about di economic transformation wey dey go on across di state, like di support for micro and small businesses, and di empowerment of artisans and traders among oda tins like massive infrastructure development, especially road construction.
Im tell im party members and di entire state say di journey dey far from ova. "We don only scratch di surface," Govnor Soludo add.
"I no go let Ndi APGA and Ndi Anambra down. I no fit and I no go take dis trust for granted." Govnor Soludo tok
Di Anambra state Govnor use di opportunity to confam Dr. Onyekachukwu Ibezim as im running mate, e say dia partnership, don produce visible results, and add say dem go kotinu to drive di next chapter of transformation.
Dr Nicholas Ukachukwu (APC)
Nicholas Ukachukwu win di Govnornship ticket of di All Progressives Congress.
Ukachukwu carry 1,455 votes to defeat Valentine Ozigbo wey get 67 votes, Johnbosco Onunkwo wit 26 votes and Edozie Madu wit 8 votes wey all contest for di ticket.
Di Chairman of APC Electoral Committee and Govnor of Cross River State, Senator Bassey Otu announce di result, afta di primary end on Sunday morning.
For im acceptance speech, Ukachukwu thank President Bola Tinubu for entire election process.
Im also praise di APC National Working Committee, Otu and im team, im co-contenders, and all delegates for dia role for di successful conduct of di primary.
"I call on my fellow contestants to unite and rally around my candidacy. Di most important thing now na to deliver Anambra to APC'', Ukachukwu tok
"I get a longstanding influence for Anambra politics. I bin get hand for di emergence of successive Govnors for Anambra ova di years. I bin play di role of godfather, but now, I dey ready to father myself." Ukachukwu add.
Dr George Moghalu (Labour Party)
Dr George Moghalu na Labour Party candidate for Anambra state Govnornship.
Di former managing director of the National Inland Waterways Authority (NIWA) secure di ticket, di Party post for di official website on Saturday.
Moghalu emerge LP flag-bearer wit a total of 575 votes from di delegates wey attend di primary election wey hold for Finotel Hotel for Awka, di state capital.