Accusations and counter-accusations between Binance executive and Nigeria goment - wetin we know

Read am in 3 mins

Di Nigeria goment don dismiss claims wey Binance head of financial crime Tigran Gambaryan bin make.

Gambaryan bin spend months in detention for Nigeria sake of alleged money laundering.

Nigeria carry am go court recently for alleged financial crimes but dem later release am afta eight months wit intervention by di United States goment.

For one post for im X handle, di financial crime oga claim say im arrest by di Nigeria goment make former US President Joe Biden to avoid a meeting im bin plan to get wit President Bola Tinubu during di 2024 UN General Assembly (UNGA).

Gambaryan blame di National Security Adviser Nuhu Ribadu for di situation and say di US goment also reduce di size of di Nigerian delegation wey fit attend di annual global assembly.

E also identify three Nigerian lawmakers wey allegedly demand bribe of $150m from am.

Counter accusations by federal goment

For one statement from di minister of information and national orientation, Mohammed Idris, e ask Nigerians to disregard di allegations.

Idris describe Gambaryan claims as a deliberate misinformation campaign.

"Di federal goment of Nigeria note wit concern di outrageous allegations, misinformation, and defamatory statements wey Tigran Gambaryan, American personnel of Binance wey dey recently tried for Nigeria for financial crimes, dey disseminate," di statement tok.

"Di goment bin reject Binance offer of a $5 million down payment in exchange for Mr. Gambaryan freedom, in favour of a more beneficial settlement wit American goment."

Idris say dem dey set di record straight to prevent falsehoods from spreading.

Di minister also address Gambaryan claims of bribery attempt, and add say im initial visit to Nigeria dey entirely discretionary and e no dey sanctioned by any goment entity.

According to Idris, investigation bin sharply begin investigate afta dem bring di alleged incident to di goment attention.

"Di first visit by Mr. Gambaryan and im colleagues to Nigeria dey discretional on dia part and di goment bin no dey officially involved.

"However, wen dem call di attention of di goment to one alleged bribery demand during dat trip, investigation immediately open into am, though formal complaint by anyone no dey," e tok.

Di federal goment bin detain Gambaryan and im colleague, Nadeem Anjarwalla, wey be 37-year-old British Kenyan wey dey serve as di regional manager for Africa at Binance.

Dem bin charge both of dem wit money laundering wey involve $35 million, as initiated by di Economic and Financial Crimes Commission.

Anjarwalla bin manage to escape from custody on March 22, 2024.

House of Reps react

Inside one official statement wey di Nigeria House of Representatives bin release in response to di allegation, dem first clarify say di accuse no be against di House, but against individuals wey dey di House.

Dem also add say dem torch light di mata wit dia members wey dey face di accuse, and say one of dem don already carry di mata go court to clear im name.

"Di Honourable Members wey dem name don assure di House Leadership say dem no ever do any of di deals wey dem dey report.

"One of di members don already institute legal action to clear im name, while odas wey dey affected, we encourage dem to do di same in pursuit of justice and protection of dia reputations," di statement tok.