European-American University deny say dem award music star Dauda Kahutu Rarara honorary doctorate degree

Wia dis foto come from, Dauda Kahutu Rarara/Instagram
European-American University tok say di conferment of honorary doctorate degree on popular Nigerian musician, Dauda Kahutu Rarara, no be from dem, as dem describe di degree as fake.
On Saturday, 20 September, di musician bin dey awarded wit di degree for one ceremony wey hold for Nicon Luxury Hotel, Abuja, di kontri capital. Dignitaries wey include di govnor of Katsina State, Dikko Radda, attend di event.
Di ogbonge musician also post di event on im official Instagram account and tank evribodi wey wish am well.
However, for one statement wey dem publish on dia official website, di institution say: Disclaimer – Fake "convocation" for Nigeria – di University no confer any honorary degree on Dauda Kahutu Rarara," di statement read.
Di institution also say dem no authorise any convocation to hold for dis location, and add say pipo organise dis event fraudulently witout di knowledge or consent of di university.
Di institution also clear am say dem no confer degrees on oda recipients wey dia names dey mentioned for di event - wey include Alhaji Ahmed Saleh Jnr., Mustapha Abdullahi Bujawa, and Tarela Boroh.
Di popular Nigerian political singer neva comment on dis development.
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post
'Organisers no get authority to act on our behalf'

Wia dis foto come from, Dauda Kahutu Rarara/Instagram
On di organisers of di event, di institution explain say di individuals wey parade demsefs as dia officials - Musari Audu Isyaku, wey claim to be dia Northern Nigeria representative, and Idris Aliyu, wey pose as member of dia governing council — no get authority to act on dia behalf.
Di institution clear am say Idris Aliyu no be member of di Governing Council of di institution and e no dey represent di Vice Chancellor of di university as dem describe am for di event.
According to di statement, di university appoint Idris Aliyu to di Fellowship of di institution wit professorial status for Financial Management for 2024, and now dem don revoke di appointment wit immediate effect sake of "im involvement wit dis fraudulent activity".
Di statement further clear am say dia current Vice Chancellor na Professor Luca Scotto di Tella de' Douglas di Castel di Ripa, no be Dr Josephine Egbuta, one former vice chancellor wey dem sack earlier dis year.
Di university also dismiss claims say dem dey based for Dominica and Panama, according to wetin dem write for di banner for di event. "Di University currently dey established as non-profit private institution of higher education for France and e also hold Royal Charter of Incorporation from di Kingdom of Bunyoro-Kitara (for Uganda)".
Di institution add say dem go contact Nigerian authorities to take action against dose behind di fraudulent convocation.
Who be Dauda Kahutu Rarara
Dem born Dauda Kahutu Rarara wey pipo sabi well-well as Rarara for Katsina State, northern Nigeria. E be political song writer and singer.
Rarara dey popular for im music and e rise to fame during di 2015 Nigeria general elections, wen e sing songs for late President Muhammadu Buhari and Katsina State govnor,
For one exclusive interview wit BBC, di popular Nigerian political singer tok say Buhari honesty na di reason why im dey sing for di Nigerian president.
For di interview, e say na since wen e be pikin, im dey exposed to Buhari honesty and integrity and im don see am as e dey grow up.
For September 2020, Rarara bin tok say im go stop to dey sing for di president until poor pipo give am one thousand naira each.










