Causes, treatment plus all you need to know about Ramsay Hunt Syndrome wey Justin Bieber say give am facial paralysis

Wia dis foto come from, Justin Bieber
Singer Justin Bieber don reveal say e dey suffer from facial paralysis afta e cancel im shows wey suppose happun dis week.
Di 28-year-old tok dis for one Instagram video say di condition na due to a diagnosis of Ramsay Hunt Syndrome.
"As you fit see dis eye dey blink. I no fit smile for dis side of my face...So full paralysis dey dis side of my face," e tok.
Ramsay Hunt Syndrome na wen a shingle outbreak affect di facial nerve near pesin's ears, medical experts tok.
Earlier for di week Bieber's Justice World Tour - wey start for February - dem announce say three of Bieber's shows go dey postponed.
"Na from dis virus wey attack di nerve for my ear and my facial nerve and don cause my face to get paralysis," di Canada-born singer tok for di three-minute video, indicating di right side of im face.
E ask im fans to be patient and tok of im forthcoming shows say e no dey "physically, obviously no dey capable to do dem".
E also smile and blink, wey show 240 million followers how do right side of im face no dey move.
End of Di one wey oda users dey read well well
"Dis dey pretty serious, as you fit see. I wish dis no be di case, but obviously, my body dey tell me to slow down," e tok."I hope say you guys understand. I go dey use dis time to just rest and relax and get back to hundred percent so dat I go fit do wetin dem born me to do."
Bieber add say e bin dey do facial exercises to "get back to normal", but dat e no know how long e go take to recover.

Wia dis foto come from, Getty Images
E suppose play for Washington DC and Toronto earlier in di week, wit concerts wey also dey planned for New York and Los Angeles for di coming weeks.
According to di Mayo Clinic for di US: "In addition to di painful shingles rash, Ramsay Hunt Syndrome fit cause facial paralysis and hearing loss for di affected areas.
Di Mayo Clinic say dat for most pipo, di symptoms of Ramsay Hunt Syndrome dey temporary, but fit become permanent.
Di inability for patients to close one eyelid fit also cause eye pain and blurred vision, di organisation add join say e dey most common in pipo over 60 years old.
For March, dem admit di singer's wife, Hailey Bieber for hospital due to blood clot in her brain.
She later reveal say she bin suffer stroke and don undergo surgery to close one hole inside her heart.
Wetin be di causes, prevention and treatment of Ramsay Hunt syndrome
Na di same virus wey dey cause chickenpox dey cause. Afta chickenpox don clear up, di virus go still dey live inside your nerves. Years later, e fit reactivate. Wen e happun e fit affect pesin facial nerves.
Quick treatment of Ramsay Hunt syndrome fit reduce di risk of complications, wey fit include permanent facial muscle weakness and deafness.
Wetin be di symptoms?
Di two main signs and symptoms of Ramsay Hunt syndrome na:
One painful red rash wit fluid-filled blisters on, in and around pesin ear.
Facial weakness or paralysis on di same side as di affected ear
Usually, di rash and di facial paralysis dey happun at di same time. Sometimes one fit even happun before di other. Sometimes di rash no dey happun.
How to prevent am?
Now children fit get vaccine against chickenpox, wey go reduce di chances of becoming infected wit di chickenpox virus. E also dey recommended make pipo wey don pass di age of get one Shingle vaccine.
Wetin be di treatment
Early treatment of Ramsay Hunt syndrome fit reduce di pain and decrease di risk of long-term complications. Medications fit include:
Antiviral drugs wey go helep fight di chickenpox virus.
Corticosteroids na also one short regimen of high-dose prednisone wey fit boost di effect of antiviral drugs in Ramsay Hunt syndrome.
Anti-anxiety medications fit helep relieve vertigo.
Prescription pain medications like pain relievers also dey needed to reduce di pain wey dey come wit Ramsay Hunt syndrome.












