Who go be Chelsea new manager?

Wia dis foto come from, Getty Images
Chelsea don start again to look for new manager afta Mauricio Pochettino comot from di club by mutual consent afta just one season for Stamford Bridge.
Pochettino lead Chelsea to sixth position in di Premier League, second for di Carabao Cup and reach semi-finals for FA Cup.
So who go be di next manager for Chelsea? Already, some names don dey pop up as early contenders.
Ruben Amorim
Afta Amorim lead Sporting to win dia first top-flight title in 19 years in 2021, e don emerge as one of di highly rated coaches in Europe.
At some point, pipo think say na Amorim go replace Jurgen Klopp for Liverpool but di Reds go for Arne Slot instead.
Chelsea don get long-term interest for Amorim body.
Hansi Flick
Currently out of job, di 59-year old German na early favourite for di job according to some bookmakers.
Flick win 70 out of im 86 games in charge of Bayern Munich from November 2019 to June 2021, as e lead di German giants to a treble of di Bundesliga, German Cup and di Champions League in di 2019-20 season.
End of Di one wey oda users dey read well well
Vincent Kompany
Tori be say Chelsea don already express interest for Kompany who currently be Burnley manager.
Kompany carry Burnley up to di Premier League last season and also carry dem go relegation dis season, but e be like say dis setback no too affect im reputation.
Bayern Munich don also indicate interest to appoint am as dia new manager.
Kieran McKenna
The 38-year-old na one of di favourites after e lead Ipswich to promotion dis season, producing some impressive, free-flowing football wit Ipswich.
Others...
Other top names wey some football sabi pipo don mention for di Chelsea top job include:
- Jose Mourinho - Three-time Champions leagie winner wit FC Porto, Chelsea and Inter Milan. E no get job now after FC Roma sack am in January
- Julian Nagelsmann - Current German national team coach, but im contract go expire after Euro 2024
- Michel Sanchez - E guide Girona to Champions League qualification dis season
- Thomas Tuchel - Also win Champions league wit Chelsea, but e perform poorly wit Bayern Munich dis season, sotee dem sack am
- Roberto de Zerbi - Qualify Brighton for dia first European competition last season, but e chop sack after di club finish 11 dis season for EPL
Top football managers wey dey take up new assignments or wey lose dia jobs

Wia dis foto come from, Getty Images
As di 2023/2024 football season for Europe don end, some top football managers don dey know dia fate as some of dem don chop sack from dia jobs, some odas don get roles for bigger clubs, while a number of odas still dey look for clubs several months aftA dem comot from dia last positions.
Here na some of di managers wey don make significant moves ahead of di next football season:
Arne Slot in, Jurgen Klopp out
Relatively unknown coach, Arne Slot, go take over from jurgen Klopp for Liverpool afta Klopp say bye bye to di Anfield fans on Sunday.
E shock many pipo wen Liverpool announce Slot wey bi former coach of Feyenoord in di Netherlands Eredivise as di replacement for Klopp wey win eight major trophies for im nine years at Anfield.
However, tori be say Liverpool bin do proper research, wey include looking at data and character bifor dem choose Slot as dia preferred candidate.
Im record wit AZ Alkmaar and Feyenoord show say Slot na manager wey dey able to over-perform compared wit di resources im get, and e also get impressive record for developing players.
As for wia Klopp dey go next, nobody know yet.
David Moyes out, Julen Lopetegui in

Wia dis foto come from, Getty Images/PA Media
Moyes bin take ova at West Ham on 29 December 2019, wen di club dey 17th on di EPL table wit only 19 points from 19 games played, but e lead qualify for European competitions three times, and even win di UEFA Europa Conference League in 2023.
Unfortunately, West Ham finish 9th on di table dis season wey mean say dem no go play European football next season, but e no dey clear whether dis follow for why Moyes decide to take a bow.
Former Real Madrid, Sevilla and Spain National team coach, Julen Lopetegui, don already agree to take over di hammers starting from next season.
Massimiliano Allegri out of Juventus

Wia dis foto come from, Getty Images
Juventus sack Massimiliano Allegri just some days afta e lead di club to win di 2024 Coppa Italia over Atalanta, and dat na di 5th time e dey lift di trophy for im career.
Allegri bin dey in charge of Juventus from 2014 until 2019, and win five Serie A trophy and four Italian Cups for di five seasons e dey dia. E also reach di Champions League final two times.
E neva dey clear who go replace Allegri at Juve, but reports say di club dey move towards Thiago Motta wey do wonders wit Bologna dis season.
Thomas Tuchel out of Bayern Munich

Wia dis foto come from, Getty Images
German giants Bayern Munich bin don win di Bundesliga 11 times back to back bifor dem hire Thomas Tuchel as dia head coach in 2023, so e dey safe to assume say Tuchel appointment na to win di Champions League.
However, Tuchel fail to win even di Bundesliga wey don become tradition for di Bavarians.
Dem also lose to Real Madrid in di semifinal of di Champions league. But di hammer wey nail Tuchel coffin na di embarrasing 2-1 loss to FC Saarbrücken in di German cup in November last year.
Bayern Munich still dey look for who go lead dia side into di next season, and di latest name for di least now na Vincent Kompany, di former Manchester City defender wey lead Burnley to relegation dis season.
Roberto de Zerbi out of Brighton

Wia dis foto come from, Getty Images
Di sack of Roberto de Zerbi na real shock for di man imsef as well as many fans of Brighton and Hoves Albion.
Afta De Zerbi replace Graham Potter in September 2022, Brighton finish for sixth position dat season and secure European qualification for di first time for dia history.
Tori be say di Seagulls dey look to hire Kieran McKenna, wey just win promotion to di Premier League wit Ipswich Town, as De Zerbi replacement.
Xavi out of Barcelona?

Wia dis foto come from, Getty Images
Whether Xavi Hernandez go remain di Manager of Barcelona next season neva dey clear, as tori be say im and di club President Juan Laporta still dey do meeting to decide.
Xavi bin announce in January say im go comot for Barcelona for di end of di season, but in April, Laporta tok say di former midfielder don change im mind.
If Barcelona decide to let Xavi go, tori dey suggest say dem fit go for anoda of dia ex players, Rafael Marquez, or former Bayern Munich manager Hansi Flick.
Mourinho, Zidane, Flick... Still no get clubs

Wia dis foto come from, Getty Images
Di trio of Jose Mourinho, Zinedine Zidane and Hans Flick na some of di top class football managers for di world we still neva get clubs after leaving dia last positions.
Of di three, Mourinho na di last to lose im job after FC Roma sack am in january dis year.
Zidane leave Real Madrid in 2021 after e tok say "di club no longer get confidence in me".
Flick, on di oda hand, na di first German national team coach to eva be sacked from di job, after a run of poor form wey see Germany comot for group stage in di Qatar 2022 World Cup.
Tori get am say Manchester United fit dey look Zidane wit corner eye as di Red Devils still dey think wetin to do wit dia current manager Eric Ten Hang.
Also, Flick fit dey on im way to Barcelona, if di Spanish giants decide to say bye bye to Xavi.
As for di Special One - Jose Mounrinho - e bin don dey reported say Saudi Arabian side Al-Qadsiah bin show interest to sign am, but e no be like say dem don make any formal approach.













