Trump plead not guilty to 34 criminal charges dem sama am

Donald Trump plead not guilty to 34 felony criminal charges during one court hearing for New York

Di former US president bin commot di court afta one hearing wey last almost for one hour

Di Judge, Juan Merchan no issue am gagg order - but ask both sides to mind dia language and expression.

Trump -dey run for di presidency for 2024 - e dey released by Manhattan District Attorney Alvin Bragg.

For statement, Bragg bin tok say: "Manhattan be home to di kontri most significant business market. We no fit allow New York businesses to manipulate dia records to cover up criminal conduct.

"As di Statement of Facts describe, di trail of money and lies expose one pattern say, di Pipo allege say, violate one of New York basic and fundamental business laws."

E accuse Trump say e repeatedly falsify business records to cover crimes. Trump don plead not guilty on all charges.

In fotos: Donald Trump chop arrest on criminal charges

Donald Trump na di first former US President to dey arrested on criminal charges.

E dey arraigned for di Manhattan Criminal Courthouse on criminal charges wey dem say relate to hush money payments e pay to adult film star Stormy Daniels for 2016.

E commot im house for Trump Tower shortly afta 13.00 local time (18.00BST).

E bin wave to waiting cameras, make fist, bifo e enter into im car.

E take just minutes for di former president motorcade to make di 6.4km drive (4 mile) from im house for Trump Tower to di Manhattan Criminal Courthouse.

During di drive, e bin post for im social media website: "E be like e dey SURREAL -- WOW, dem dey go ARREST ME".

E look calm and serious as e waka into di courthouse, e pause to wave at di crowd.

As e enter inside, e surrender to di authorities and dey booked and processed. E den waka into di courtroom.