Wetin you need to know about Olayemi Cardoso wey Tinubu nominate to serve as new CBN govnor

Olayemi Cardoso

Wia dis foto come from, Olayemi Cardoso

Nigeria President Bola Tinubu don approve di nomination of Dr. Olayemi Michael Cardoso to serve as di new Govnor of di Central Bank of Nigeria (CBN), for a term of five (5) years first pending im confirmation by di Nigerian Senate.

Di nomination dey subject to confirmation by di Senate of di Federal Republic of Nigeria.

Meanwhile, President Tinubu also approve di nomination of four new Deputy Governors of di Central Bank of Nigeria (CBN), for a term of five (5) years first, pending dia confirmation by di Nigerian Senate.

Dem be:

  • Mrs. Emem Nnana Usoro
  • Mr. Muhammad Sani Abdullahi Dattijo
  • Mr. Philip Ikeazo
  • Dr. Bala M. Bello

Dis tori dey come as di former CBN govnor Godwin Emefiele dey face charges of illegal possession of firearms.

Authorities charge Emefiele afta President Tinubu suspend am sake of investigation of im office and plan dem get to reform di financial sector.

Emefiele bin don dey in di eye of di storm afta di 'new naira note policy' dem launch just before di general elections for February 2023 cause kasala and lead to economic hardship for citizens as a result of naira scarcity.

CBN bin roll out a policy wey introduce new naira notes of N1000, N500 and N200 in a bid to take out di old currency in those values out of circulation. But di plan no go smoothly.

In defence of di policy den, Emefiele bin say CBN dey face problem wit di management of di current series of banknotes wey dey circulation, especially di ones wey dey outside di banking system for Nigeria.

Who be Olayemi Cardoso?

Olayemi Michael Cardoso na Nigerian banker, chartered stockbroker and public policy expert.

E don serve for over four decades for di public, private and development sectors as a leader and innovator.

E serve as Commissioner for di Lagos State Ministry of Economic Planning and Budget; Chairman of di board of di African Venture Philanthropy Alliance and, most recently, Chairman of Citibank Nigeria Ltd for 12 years, until im resignation for 2022.

Cardoso, wey be Lagosian, attend Corona School Ikoyi and St. Gregory College for Lagos for im primary and secondary education.

E complete im undergraduate studies afta e get Bachelor degree (B.Sc.) in Managerial and Administrative Studies from Aston University for 1980.

E later further im education for Harvard Kennedy School of Government (HKS), wia e get Masters degree in Public Administration for 2005 as a Mason Fellow.

In recognition of im contribution for private and public sector, Aston university give Cardoso a Doctorate in Business Administration (DBA) (honoris causa) for 2017.

E also be Fellow of di Chartered Institute of Stockbrokers.

Cardoso dey married with five children and three grandchildren.

Im parents be descendants of Brazilian returnees and come from ogbonge families from Popo Aguda.

Im papa, Felix Bankole Cardoso, na di first indigenous Accountant-General of di Federation of Nigeria for 1963; and, di first indigenous Vice Chairman and Managing Director of Barclays Bank of Nigeria afta e join di bank for 1972.

Na under am Barclays become Nigerian entity, Union Bank of Nigeria.