'If no be for me wey stand behind Buhari, im for no become president'

Bola Tinubu

Wia dis foto come from, instagram/officialasiwajubat

Nigerian politician and member of di ruling All Progressives Congress (APC) Bola Tinubu don tok about im role to make president Muhammadu Buhari win election for 2015.

Tinubu tok am on Thursday for at di Presidential Lodge in Abeokuta, Ogun State inside South West of di kontri as im dey address di party delegates ahead of di party convention and primary election wey go hold on June 8.

Di video don dey trend ontop social media.

Di party chieftain say if no be for im efforts, President Buhari for lose di election wey make am emerge as di kontri democratic president for 2015.

“If no be for me wey stand behind Buhari, im for no become di president. Im try am di first time, e fail. Di second time, e fail. Di third, e fail,” Tinubu tok

President Muhammadu Buhari wit Bola Tinubu

Wia dis foto come from, officialasiwajubat

Tinubu wey be one of di aspirants wey dey battle for di APC presidential ticket, tell di delegates say; “E even cry on national television and vow never to contest again but I go meet am for Kaduna and tell am say e go run again, I go stand by you and you go win, but you no go joke wit Yorubas and im agree.”

Tinubu wey be former Lagos State govnor and national leader of di party make dis statement- wey don since cos tok-tok across social media for di kontri - as e dey campaign to get di ticket to run for presidential candidate of di party come 2023.

E also tok am during di meeting wit delegates say, na di turn of Yoruba pipo to become di kontri president for di next election.

"And if we wan select from di Yorubas na my turn", Oga Tinubu tok.

Oda things e tok

Di former governor of Lagos State say since Buhari become President, im neva benefit anything from am. 

“Since im become President, I no gbab any ministerial slots,” e tok. “I no collect any contract, I no beg for anything from am. Na di turn of Yoruba, na my turn.”

According to am, im don wan be di kontri president since im days for di Action Congress (ACN), as im also torchlight im role for di political careers of several many leaders including Vice President Yemi Osinbajo.

“Im sabi say di calculation dat time no favor us. Na why im want me as im vice but I tell am to allow us build di party first.

"And wen we finish building di party. we bring in pipo from di PDP, Saraki see say those wey dey PDP no go get anything if Buhari, a Muslim, become di President and if me, wey also be Muslim become im vice, im wan get di Senate President and di Senate President also no fit be Muslim.

"Dat na how dem start di campaign against me,” Tinubu explain am.

APC Presidential Primaries and di 2023 elections

Election season don start for Nigeria and di race for who go replace President Muhammadu Buhari for Aso rock don dey hot.

For di ruling All Progressives Congress, APC, over twenty aspirants don declare dia interest to run for di highest office for di land.

Apart from former Lagos State Governor, Bola Tinubu, and Vice President Yemi Osinbajo, oda aspirants na di Senate President Ahmad Lawan and former ministers Rotimi Amaechi, Ogbonnaya Onu, Godswill Akpabio, and Chukwuemeka Nwajiuba.

Serving govnors wey also dey aspire to be president na Kayode Fayemi (Ekiti), Yahaya Bello (Kogi), Dave Umahi (Ebonyi), Ben Ayade (Cross River) and Badaru Abubakar (Jigawa).

Odas include former Senate President Ken Nnamani, former House of Representatives Speaker, Dimeji Bankole, and serving senators Ibikunle Amosun, Ajayi Boroffice, and Rochas Okorocha plus many odas.

Di APC dey expected to hold a convention between June 6 and 8 wia di party flag bearer go emerge.

Meanwhile President Buhari recently hold meeting wit APC state govnors wia e say “our objective must be di victory of our party and dia choice of candidate must be pesin wey give di Nigerian masses a sense of victory and confidence even before di elections.”

Di President also appeal to all di govnors “to allow our interests to converge, our focus to remain on di changing dynamics of our environment, di expectations of our citizens and di global community.”

Di kontri general election go happun for 2023, according to di Independent Electoral Commission.

Next year, Presidential and National Assembly elections go happun for February 25, 2023 according to di election office INEC.