You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Tributes pour in for Kenya gospel singer Betty Bayo wey die
President Williams Ruto don join many Kenyans to mourn di death of popular gospel singer Beatrice Wairimu Mbugua wey pipo sabi as Betty Bayo.
Di family of Betty announce her death on Monday, 10 November. Dem say she die afta one private battle wit advanced leukaemia.
Her death still be shock for di kontri, as some of her fans don flood her social media pages to question if she truly don pass.
Reports say di 43-year-old singer, bin keep her diagnosis secret, as she appear active and well for most of her fotos for social media.
Tributes for Betty Bayo
President Ruto for im tribute describe Betty as an extraordinary gospel artiste wey her voice carry hope into di hearts of countless Kenyans.
Her song, Breakthrough hit, "11th Hour," na powerful anthem of divine turnaround wey inspire di faithful and comfort many wey dey find strength, healing and reassurance in gospel music." E tok.
E add say for ova 15 years, Betty bin lift spirits through music wey speak of resilience, renewal and steadfast faith for di face of life challenges.
"Her voice fit don fall silent, but her ministry live on for every heart she touch, every soul she uplift, and every life she help steady in difficult moments."
Former Kenya Deputy President Rigathi Gachagua also say di tori of Betty passing na sad tin to am and di whole kontri.
E pray for comfort for di family she leave behind.
Betty Bayo na popular Kenyan musician wey dey often sing for her native tongue, Agikuyu.
She rise to prominence during di 2010s as part of one strong wave of Kikuyu gospel singers.
Her voice and her songs cut across church walls and bicom trendy songs for town halls, household radios, and online platforms.
Some of her best-known songs include "11th Hour", "Gatho", "Jemedari", "Thiiri", "Udahi", "Ndîkerîria", "Maneno", and "Agocwo".
Dis songs dey mix worship wit personal storytelling. She sing about waiting on God at late hours, about seasons of loss and gain, and about di small struggles wey dey shape life.
As a performer, Betty dey energetic and direct. Her live shows dey always dey mixed wit praise and testimony.
She dey often use her stage time to share parts of her story wey involve di time wey she serve as housemaid, wen she return to school, di years of hustle — and den she go sing prayer for di pipo wey dey present.
Fellow gospel musicians and church leaders bin hail her for her authenticity and a clear heart for ministry.
For Kenya gospel scene, she dey known as a steady voice wey bring joy and honest testimony to every stage.