You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Paystack suspend co-founder Ezra Olubi over allegations against am
Paystack wey be Nigerian payments startup don suspend dia co-founder and chief technology officer, Ezra Olubi over allegations against am.
Di company for dia statement wey dem send to BBC News Pidgin also tok say dem don open formal investigation into di allegations.
"Paystack dey aware of di allegations wey involve our Co-founder, Ezra Olubi. As of Thursday evening, November 13, 2025, Ezra don dey suspended from all duties and responsibilities pending a formal investigation.
"In accordance wit our internal policies, we don initiate a review process wey Paystack Board dey lead," Paystack tok.
Di company add say di board dey in di process of appointing independent third-party investigator to ensure say di investigation dey conducted fairly, thoroughly, and wit full confidentiality.
"To protect di integrity of dis process, we no go comment further until di investigation don complete."
Paystack add say dem remain committed to maintaining workplace wey safe, respectful, and supportive for all employees.
Di company no tok specifically wetin di allegations be.
BBC News Pidgin don reach out to Ezra for comments.
Who be Ezra Olubi?
Ezra Olubi according to im LinkedIn account na Nigerian entrepreneur, co-founder and CTO for Paystack. E be Software development veteran, technology consultant, needs assessment expert and e get specialties for Online Payments, Business Automation, Consumer Web, Ecommerce Systems.
E also don work wit plenty ogbonge organizations.
Dem born Ezra for 1986 for Ibadan, Oyo state, South West Nigeria.
American financial services company Stripe for 2021 bin acquire Paystack for a reported $200 million.
Ezra and Shola Akinlade establish Paystack for 2016 as a solution for merchants for Nigeria and Ghana to receive payment anywia for di world.
As at 2021, Paystack bin dey process ova 50% of all web payments for Nigeria, as well as payments for ova 60,000 organisations, including FedEx, UPS, South African mobile operator MTN and many odas.
Ezra na also OON, Officer of the Order Of The Niger.
For di 2022 National Honors event wey hapun on October 11, Ezra Olubi receive di award from di den President Muhammadu Buhari.