Gentleman Mike Ejeagha wey sing 'Gwo gwo gwo ngwo' don die

Ejeagha nwụrụ ka ọ rịachara ọrịa were ogologo oge, bụ nke ezinaụlọ ya akpọghị aha.
Read am in 3 mins

Nigeria highlife music legend, Mike Ejeagha, don die at di age of 95.

Di ogbonge musician, wey dem sabi as 'Gentleman Mike Ejeagha,' bin popular for many years sake of im high-quality music wey im bin take tell different kain of stories.

Im son, Emmanuel Ejeagha, tell BBC News say im papa die for 82 Division Hospital for Enugu, around 8:00 p.m. on Friday, June 6, 2025.

Mike Ejeagha die afta one long sickness, wey im family bin no tok im name.

Ejeagha blow for Nigeria music for di 1980s sake of how im music style take dey unique.

For 2024, Nigerian skit maker Brain Jotter, bring di ogbonge highlife singer Ejeagha back into di limelight again wen e make popular one line, 'Gwo gwo gwo ngwo' from di singer song, "Ka Esi Le Onye Isi Oche," na song for Mike Ejeagha 1983 album.

Di dance to di song go viral and bin make pipo remember di ogbonge singer.

Celebrating di legend

Pipo from different levels of society dey celebrate di late music legend for im unforgettable work, even as dem dey condole im family.

Di Enugu State Govnor, Peter Mbah describe di late Ejeagha as "easy personality" wey im fans "cut across boundaries."

Im talent show for how im take simple folktales and turn dem into songs wey you no go fit forget, and wey pipo from different cultures fit understand.

Atiku Abubakar, former Nigeria Vice President post for social media X say: "E dey heartwarming to note say thanks to Brain Jotter, highlife maestro Mike Ejeagha bin get im 'Gwo gwo gwo ngwo' encore dance before di curtain drop down. Rest in music, Gentleman Mike Ejeagha."

Who be Gentleman Ejeagha

Ejeagha special talent na im gift to tell stories wit plenty proverbs inside, as im dey play guitar.

Im most popular song of all time na di 'Gwo Gwo Gwo Ngwo' song.

Di song climb to No. 81 on Apple Music Nigeria. Dis one make Pa Mike di oldest Nigerian artist to ever enta di chart.

Im album "Akụkọ N'egwu Original Vol. 1" also enta Spotify Nigeria Top 100 Albums, 41 years after im drop am.

Dem born Mike Ejeagha for Ezeagu, Colony and Protectorate of Nigeria, wey now be Ezeagu local goment for Enugu State.

Im bin attend St Patrick Primary School, Ogbete, Enugu.

For 1945, im join one popular local music group, Coal Camp Boys.

E bin later become host of one radio programme wey dem call Guitar Playtime, for Nigerian Broadcasting Service.

Im form one band wey im call Premier Dance Band, wey im later disband during di Biafra War.

For 1972, e become guest presenter for Nigeria Television Authority for one Igbo programme Akụkọ N'egwu wey add more to im popularity.

Im bin get influence on di development of music for Igbo language for more dan 60 years.