Key benefits of Ginger for your body

Foto of ginger and tea cup wey sometin dey inside

Wia dis foto come from, Francesco Carta/Getty Images

    • Author, Abubakar Maccido
    • Role, Reporter
    • Reporting from, Kano
  • Read am in 3 mins

Weda na to cook food, herb or to make hot tea wen bodi no too dey okay, ginger na one popular root wey eviribodi sabi.

Pipo for all over di world, don dey use ginger tey-tey.

For one interview wit BBC News Pidgin one dietitian for Kano Sa'adutu Sulaiman tok say "No be just say ginger sweet, e get plenty correct tins inside am" wey dem dey call bioactive compounds.

She mention tins like gingerol (wey dey fresh ginger) and shogaol (wey dey more for dry ginger) - na dis tins dey make ginger powerful for bodi.

Dietitian Sulaimain add say for women research show say if you take one-eighth teaspoon of ginger powder three times a day, starting one day before your period, e fit reduce di heavy flow by half and e go dey better as you kontinu.

Benefits of ginger for bodi

Dis na some of di health benefits wey dey inside ginger according to di dietitian:

  • E dey fight sickness and make your body strong: Ginger dey help boost your immune system. Dat one mean say your bodi go fit fight infection well-well, like wen you catch cold or dey feel somehow.
  • E stop nausea and vomiting: If your belle dey turn you or you wan vomit, ginger go help you. For pregnant women wey dey get morning sickness, just half teaspoon of ginger powder fit reduce di vomiting and dat bad belle feeling. E still dey help pipo wey do surgery or dey take strong medicine like chemotherapy.
  • Na natural pain killer: Ginger dey work well for pain, and e beta pass many pain medicine wey you go buy for chemist.
  • For migraine headache: E dey amazing! Just one-eighth teaspoon of ginger powder fit work like strong migraine medicine, but e no go give you wahala like dizziness or heartburn.
  • For menstrual cramp (Dysmenorrhea): Ginger fit work like ibuprofen for period pain. You fit take from one-third teaspoon reach one full teaspoon for di first few days of your period.
  • E reduce heavy bleeding: If your period dey heavy, ginger fit help. Research show say if you take one-eighth teaspoon of ginger powder three times a day, starting one day befor your period, e fit reduce the heavy flow by half and e go dey better as you kontinu.
  • For joint pain (Osteoarthritis): If your joint dey pain you (like arthritis), ginger fit reduce di pain. E dey work like ibuprofen but e no go spoil your stomach. In fact, ginger fit even protect your belle. Just dey take quarter to half teaspoon of ginger powder every day.

Nutritional Profile

Ginger; raw (per 100g) get about:

  • Energy: 80 Kcal (calories)
  • Carbohydrate: 17.77g
  • Fiber: 2.0g
  • Protein: 1.82g
  • Fat: 0.75g
  • Iron: 0.60mg
  • Folate: 11µg
  • Cholesterol: 0mg
  • Saturated Fat: 0.203g
  • Monounsaturated Fat: 0.154g
  • Polyunsaturated Fat: 0.206g