You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Trump dey meet Nato chief sake of 'major' statement on Ukraine
US President Donald Trump dey expected to make wetin e call a "major" statement today, afta e say di US go send Ukraine "various pieces" of ogbonge military equipment.
E dey meet di Nato Secretary General Mark Rutte for di White House today to tok issues wey surround Russia and Ukraine.
Meanwhile, Ukrainian President Zelensky meet wit di US envoy to Ukraine, Keith Kellogg.
Zelensky say e get "productive" tok wit di US envoy to Ukraine Kellogg, for Kyiv.
US President Trump tok on Sunday say im go send Patriot air defence missiles to Ukraine bicos Russia President Vladimir Putin "go tok nice for morning den bomb evribody for evening".
Trump no tok how many missiles im dey plan to send go Ukraine, but e say United States go get bak dia moni for di weapons.
Oga Trump don dey tire for Putin becos im believe say di Russia President dey postpone im attempts to negotiate ceasefire between Ukraine and Russia.
Trump dey expected to announce new plan to arm Ukraine wit offensive weapons. Dis na sharp u-turn from im earlier tok.
Wen US President Trump clash wit Zelensky for di Oval Office on Friday, 28 February, e tell am to make deal wit Russia "or dem go comot body".
Since dat time, Trump still dey ontop Ukraine matter as bombing still dey go on for di kontri and e dey concern about dia defence.
For im new post for im Truth Social social media platform, President Trump say dem dey "rip off" di US on trade and military spending for decades, e claim say e dey cost di kontri trillions of dollars.
"Make kontris sit back and say: tank you for di many-years-long free ride, but we know say you gatz do wetin dey right for America. We go respond by saying: tank you say you understand di situation we dey in. We appreciate!" e write.
Since e takeova office, Trump don dey put pressure on US allies to increase dia spending, especially for dia defence.
Much of im criticism dey focused on Nato member states, wey di US dey historically ranked among di highest military spending.
For dia response, Nato 32 members don agree to spend 5% of GDP on defence and securiti by 2035.
Today visit to di White House no be Nato Secretary General Mark Rutte first trip to di 1600 Pennsylvania Avenue.
E go for 13 March, but for different reason. Di meeting come just weeks afta Ukrainian President Zelensky visit di Oval Office.
Na time wey Trump and di White House bin kontinue to insist say a ceasefire dey around di corner.