You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Five key tins Bola Tinubu tok for Chattam House
Di presidential candidate of di All Progressives Congress (APC), Bola Ahmed Tinubu don address di controversies wey sorround im age, school and record for di private sector.
Bola Tinubu wey tok for Chatham house for London on Monday 5 December insist say im birth, academic, and professional records dey consistent.
E say im critics only dey waste dia time and money.
Tinubu say, "At di time of birth wey di date be March 29 1952 for di family record, I no think say dat day I don determine to be president of Nigeria or make I decide say I wan be president, not even say I go go to polls".
"I get better exposure for life, my record dey consistent for school for di university. Di record dey there.
"Di record dey there, di Transcript dey there wey show March 1952 … I no claim anoda papa, I be Tinubu, and Tinubu proper. If dem want DNA dem fit ask for one". e further tok.
“Deloitte, Chicago State University where I bin graduate from don attest to dat. Now, I fit announce say I don receive my original replacement degree certificate from dem,” Oga Tinubu also add.
Tinubu bin show face for Chatham house wia e bin tok and answer kwesion about ‘Nigeria 2023 Elections: Security & Economic Development and Im Foreign Policy Imperatives’.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di APC presidential candidate bin waka wit, Speaker, House of Representatives, Femi Gbajabiamila; Kaduna and Jigawa State State Governors, Nasir El-Rufai, and Abubakar Badaru; former Ekiti State Governor, Kayode Fayemi; and plenti oda of im supporters.
Key tins from wetin Tinubu bin tok
Oga Tinubu bin tok about plenti tins wey centre around security, employment, power, Agriculture, health and odas but here be some of di tins wey im tok .
Elections for Nigeria
Tinubu say time don reach again for Nigerians to go to di polls to elect di next set of leaders. Di national election wey go shelle for di first quota of 2023 fit dey considered as especially significant for Nigeria quest for democratic consolidation.
Di 2023 election go happun on di back of almost 25 years of civilian rule wey never break.
E say di All Progressives Congress party don distinguish demself for election management area.
E say today, elections dey more credible dan ever since democracy return for 1999.
"E say recent engagement, enactment and make pesin allow di use of technology, di tools for di accreditation of voters, transmission of result go deliver di fairest and freest election for di nation history" e tok.
"Dis one dey important as di next president of Nigeria go get some tough choice to make and no go dey able to do so wit questionable electoral mandate" Tinubu add.
E also call di attention of Nigerians to di issue of Ballot security and election violence as e be ogbonge areas wey concern dey.
Wahala for social media
Political conversation on social media don become more laced wit violence rhetorics and threats of violence against anybody wey oppose di oda pesin choice.
"I tanda firmly against all form of electoral violence and intimidation".
"I don spend most of my career as political opposition, I don fight wella against electoral malpractice, and any attempt to cancel legitimacy of choice of voters I go continue to do so, I promise" e also add.
To address di issue of insecurity, we ghas tackle unemployment, poverty eradication
Agriculture
Oga Tinubu say,di present administration don invest heavily for agriculture as dem provide loans and plenti oda tins.
Im go build on dis one but im say focus go dey on use of technology expertise to speed up growth and development.
E say how dem go fit achieve dis one na to provide di critical infrastructure wey dey necessary to achieve di commodity transformation for di Agricultural value chain.
"Road rails, access to polls restorage and infrastructure are wetin dey require to radically transform di agricultural sector and increase di value to di nation".
"If dis na di area of our focus, so dat di full potential of our Agro-economy go dey achieved and we go fit reap di benefit inside jobs, improved economy, opportunities and increased prosperity" Oga Tinubu further add.
Power
Bola Tinubu say as e be sayfor Nigeria don privatise di power distribution for Nigeria and generation to one kind degree.
Wetin im ghatsz do going forward be to improve di enabling environment and further reform di legal regulatory frame work wey go attract more private investment for di sector as di kontri don experience am for di telecom industry.
Foreign policy Nko?
For dis one Oga Bola Tinubu say e be to operate for anoda level. "For anoda level make learn how we go make foreign policy work better for our domestic, social and political priority".
"Sake of dis we ghatz renew our foreign policy apparatus so e go fit take full advantage of global initiatives and processes wey go work for di kontri and our domestic priorities".
Security
To tackle security wahala, Tinubu say im administration get mind to do three tins wey include to amend di constitution to accommodate policing for federal, state and community level, e say if security foot print increase di kontri go get less criminal activity.
To check di armed forces and security architecture, as dem go equip dem wella and train dem pass as e be now, among oda tins wey dem go take solve di security kasala.