Trump go return to Twitter? Account of di former US president reappear afta Musk lift suspension

Twitter new owner Elon Musk don bring back Donald Trump account afta dem do poll wia users narrowly support di move.

"Di pipo don tok," Oga Musk tweet am, say 51.8% of more than 15 million Twitter users vote for dem to lift di ban. 

But di former US president fit no return to di platform, as im don tok say: "E no see any reason for am".

Dem suspend im account for 2021 sake of di risk say e dey incite violence. 

Twitter previous management bin act just days afta Donald Trump supporters storm di US Capitol for Washington DC on 6 January. 

Hundreds of rioters enter di complex as di US Congress bin attempt to confam Joe Biden victory for di presidential election. Di violence wey follow lead to di deaths of four civilians and one police officer.

Afta dem ban Oga Trump – wey get tens of millions of Twitter followers – im later launch im own social media platform, Truth Social. 

Earlier dis week, di Republican announce say im go run again for di US presidency for 2024.

Oga Musk, wey be di world richest man, take control of Twitter for October for one $44bn (£37bn) deal. 

Im immediately begin on one series of radical changes within di social media giant, as concern dey say im fit relax Twitter regulations on hate speech and misinformation.

With just ova one week before di US midterm elections on 8 November, im respond to questions about whether im go bring back Oga Trump account afta im tweet say "If I get a dollar for every time pesin ask me if Trump dey come back on dis platform, Twitter go dey print money!"

Earlier dis week, im tell employees say di company office buildings go dey temporarily closed, wit immediate effect.

Di announcement dey as report comot comes say large numbers of staff dey resign afta Oga Mr Musk call on dem to sign up for "long hours at high intensity" or leave.

Trump go return to Twitter?

Donald Trump sabi say di dey significant - even though im official position na say im no wan return to Twitter. 

E ask im followers on Truth Social to take part for di poll. "Vote now wit positivity, but no worry, we no dey go anywia. Truth Social dey special", e tok. 

Na odd statement. If Mr Trump no dey think of returning, why im ask im followers to vote?

Part of Mr Trump's dilemma na say Truth Social no get users like Twitter. For September, app analysts Sensor Tower estimate am say na just 92,000 people download Truth Social. Nearly 15 million pipo download Twitter over di same period. 

Oga Trump go love to get im megaphone back. Twitter na im favourite app, di one platform wey im use drum up support, and dominate di news cycle. 

But as im go get a far greater reach on Twitter, e get financial interest to make Truth Social succeed. Na Trump Media & Technology Group get di app, and if im go back to Twitter, e go hard for Truth Social to continue. 

Dis wan help to explain why we no dey see Donald Trump dey Ginger to come back to Twitter - yet. 

But in di longer term, im go need weigh up financial decisions wit political ones, and wit intentions to run for president again – we no fit rule am out say im no go come back.