You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Speed Darlington released after days inside cell
Foto of Speed Darlington and im lawyer, Deji Adeyanju don dey trend online, afta dem release di Nigerian rapper from Nigeria police force custody.
Di bail conditions of Darlington no clear but e leave police cell on Tuesday - days afta im arrest.
Oga Adeyanju thank Omoyele Sowore and oda Nigerians for raising dia voice for Speed Darlington.
"Must also appreciate Professor Sanusi and im team at IRT for di professionalism today," e tok.
Earlier on Tuesday, Speed Darlington Okoye, mother cry and beg ontop social media make dem release her pikin from police custody afta Burna Boy allegedly carry am comot from im house.
Queen Theresa, wey dey narrate her ordeal tok say na Speed Darlington gateman tell am say some pipo come carry her son afta im post one viral video on social media.
She dey cry say make Nigerians help am beg dos wey arrest im pikin to release am.
“I just get di information say my pikin, Speed Darlington dey miss. Na im gateman call my family and notify my family say e get one video wey Speed Darlington do about Burna Boy," she tok.
For days now, e don dey trend ontop social media say Speed Darlington dey miss and pipo no know wia e dey.
Nigeria human right lawyer, Deyi Adeyanju, don confam ontop X say Speed Darlington dey for police custody.
Oga Adeyanju tok say dem don locate am and e go do anytin to free am from police custody.
"We don dey involve in di Speed Darlington matta. We go do everytin to free am. We beg di authorities make dem stop di clampdown on freedom of speech in Nigeria," e tok.
"You no fit dey sing against oppressors and still be oppressor."
"We have just locate Speed Darlington and we dey work on freeing am. Di attack on freedom of expression in Nigeria must stop."
One viral video wey dey circulate ontop social media show wia, Speed Darlington dey ask Burna Boy how e take win im Grammy award in 2021.
Di 39-year-old wey pipo sabi as "Akpi" ask di Grammy award winner, Burna Boy if Diddy rub "oil for im nyash" bifor e win di trophy.
"E no tey afta Burna Boy post im foto wit Diddy na im, e win Grammy," e tok
"I just dey wonder, Burna Boy I dey ask you kwesion. No vex . How many oil Diddy drop for your nyash bifor dem give you trophy."
Video of im arrest don dey trend ontop social media, afta some pipo accompany am comot for im gate.
Meanwhile, di main pipo behind di arrest of 'Akpi', as Darlington dey call imsef neva come out come tok.
Afrobeats giant Burna Boy wey evri body dem call im name also neva chook mouth for di development.
About Speed Darligton?
Speed Darlington na di son of Nigeria singer Pericoma Okoye, wey die on 16 February 2017 in Okigwe. Im mama na Queen Theresa Onuorah.
Di 39-year-old dey controversial for making im social criticism in di entertainment industry.
Speed Darlington dey popular for im work as entertainer and rapper wit several music to im name "Greatest Tank Battle", "My Party", "Hustle Hard", and "Let’s Dance."