Russia don charge four men wit terrorism sake of Moscow concert attack
Russia don charge four men go court wey dem claim say attack one Moscow concert hall and kill at least 137 pipo.
Dem carry three as dem bend down enta Moscow court as di fourth pesin dey wheelchair. All of dem dey face charges say dem commit act of terrorism.
Di Islamic State group or IS say na dem run di Friday attack on Crocus City Hall and dem even release video proof.
Russian officials don claim witout any evidence say Ukraine hand dey inside. Kyiv say dat claim no make sense.
Di four men wey Russian authorities drop dia name na Dalerdzhon Mirzoyev, Saidakrami Murodali Rachabalizoda, Shamsidin Fariduni and Muhammadsobir Fayzov.
Video comot wey show masked policemen dey drag three of dem go di Basmanny district court for di Russian capital.

Wia dis foto come from, Reuters
All di men be like dem beat dem, as Russian security forces leak videos of brutal interrogation, and tori comot wey suggest say at least dem sama one of dem electric shocks.
Di men wey di court say dia name na Mirzoyev and Rachabalizoda get black eyes and Rachabalizoda ear bin dey bandaged - tori be say dem cut half of di ear comot during im arrest.
End of Di one wey oda users dey read well well
Mirzoyev also show face for court wit plastic bag wey don tear around im neck.
Di face of di man wey dem call Fariduni bin swell wella, while di man dem call Fayzou look like say im don faint as dem carry am enta court for wheelchair as im dey wear hospital gown.
E look like im eye don miss, according to di Reuter news agency.
All of dem bin dey inside glass booth as masked police guard dem for dia time for court.
Court statement for Telegram say Mirzoyev don "admit im guilt in full" while Rachabalizoda also "admit guilt".
Di men bin dey identified as citizens of Tajikistan, Russia state agency, Tass tok.
All four go dey pre-detention until at least 22 May, na wetin court tok.

Wia dis foto come from, Reuters
Four gunmen bin enta di Crocus City for Krasnogorsk on Friday night, wey dey for northern Moscow and start to dey shoot about 6,000 pipo wey bin dey attend rock concert. Di attackers also start fires wey burn di venue and make di roof to collapse.
Russian authorities say 137 pipo bin die and ova 100 injure.
Di men wey show for court on Sunday, dem bin arrest dem for di Bryansk region 14 hours afta di attack, na wetin Russia Federal Security Service (FSB) tok.
IS don already claim responsibility for di attack say na dia branch, wey dem dey call di Islamic State in Khorasan, or IS-K run am.
Dem later reveal video wey show as di attackers dey shoot gun to di crowd inside di concert. BBC don verify say dis videos dey real.
Howeva no Russian official don acknowledge am as IS handwork and dem claim witout proof say di attackers na Ukraine dey help dem, and say Kyiv arrange for dem to cross di border enta Ukraine territory.
Ukraine President Volodymr Zelensky on Sunday reject di claims and im military intelligence directorate say e no make sense to suggest say di men bin dey try cross heavily mined border, wia hundreds of thousands of Russian sojas full to reach safety.
Adrienne Watson, wey be di US national security council tok-tok pesin say di IS get di "only responsibility for dis attack. No Ukrainian hand dey inside at all at all."
Meanwhile dem don arrest seven oda pipo for Russia say dem help di attack happun.
Why Russia dey enta IS eye?
Di US bin warn Moscow earlier dis about a possible attack for Russia wey go target large gatherings - dem also issue a public advisory to citizens wey dey di kontri.
Kremlin no too send di alert wey dem call propaganda and wey dey try chook mouth for dia presidential election.
Washington say afta di attack, dem no get reason to doubt IS claim.
No be di first time wey IS and dia allies don attack Russia or dia interests abroad.
Di group claim say na dem bomb one Russian plane ova Egypt for 2015 wey bin get 224 pipo inside, most of dem na Russians dem be. Dem also claim say na dem do one 2017 bomb attack for di St Petersburg metro wey kill 15 pipo.
Security analysts say di reason di group dey target Russia include di kontri role for destroying IS power base for Syria as dem secure President Bashar al-Assad for office, Moscow two brutal war for Muslim majority Chechnya for 1994-2009 and di Soviet era invasion of Afghanistan.
IS-K dey mostly operate for Afghanistan and parts of Central Asia and dia name na from di old name of di region.
E dey among di most active of di IS branches and dey responsible for di deadly suicide attacks for Kabul airport wen America bin dey do kiti-kata to comot for August and September 2021.
Dis branch dey normally yab President Vladimir Putin for dia propaganda.















