Timeline of how Moscow concert attack wey kill over 130 pipo happun

Smoke from fire rise above di burning Crocus City Hall concert venue

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Smoke from fire rise above di burning Crocus City Hall concert venue

Russian President Vladimir Putin say dem don arrest all di four gunmen wey carry out deadly attack for one packed concert venue for Moscow.

At least 133 pipo die and more dan 140 pipo injure wen di attackers storm di building, begin shoot anyhow and set di venue on fire.

Authorities say dem detain 11 pipo in total, and dem catch di four gunmen as dem dey go Ukraine.

Di Islamic State (IS) group say na dem dey behind di attack.

On Saturday, IS-linked news agency Amaq bin share on Telegram one foto of di four masked men dem claim say dey involved for di attack.

Russia neva comment on di IS claim.

For inside one televised address, Oga Putin condemn di massacre - di deadliest for Russia for nearly 20 years – e say na "barbaric terrorist act" and e bin repeat earlier suggestions by Russian security services say di attackers bin try to escape go Ukraine.

Kyiv don dismiss di claim say dem get hand for di attack.

"To suggest di suspects dey come Ukraine, go suggest say dem stupid or suicidal," Andriy Yusov, one tok-tok pesin for di Ukrainian military intelligence directorate, tell BBC.

Timeline of how di attack take happun

Wetin we call dis Video, People take cover as gunmen enter Moscow concert hall

Reports of serious attack inside di Crocus City Hall, for Moscow Krasnogorsk suburb, begin spread for around 20:00 local time (17:00 GMT).

Up to 6,200 bin gada dia for one Friday night rock concert wey veteran band Picnic organise wen di shooting start.

One video wey show for social media show several men for camouflage dey waka across di concourse, wia dem open fire for members of di public, before dem re-arm and enta di hall.

Di video show as crowds of pipo dey scream and run in panic as di men burst inside di hall. E show as some odas dey hide behind dia seats as di men fire into di auditorium.

Di number of those wey die still dey rise.

By Saturday afternoon, at least authorities confam say133 pipo dead. Di first official list of casualties bin suggest say di oldest victim dey in her 70s, wit three children among di dead.

In addition to those dem kill, at least 60 dey for serious condition and authorities don warn say more fit die.

Many of those wey die and injure come from Krasnogorsk, Khimki and oda nearby towns on Moscow north-western fringe.

Wetin we call dis Video, Moscow attack: 'Di first thing you notice na di smell'

Di Russian Investigative Committee tok say di attackers use flammable liquid to set fire to sections of di concert hall.

Dem add say na gunshots wounds and poisoning by combustion products cause di deaths of di victims.

Some 14 hours afta di first reports of shooting, Russia Federal Security Service (FSB) announce say dem don arrest 11 pipo, including four wey dey "directly involved".

Dem neva announce dia identities. Russia interior ministry say dem be foreign nationals.

Unconfirmed reports don mention nationals from Tajikistan - Oga Khinshtein say dem see passports from di kontri inside one car.

Men light candles for makeshift memorial for di Crocus City Hall

Wia dis foto come from, Reuters

On Saturday, dem set up makeshift memorial outside di concert hall wia Muscovites light candles and lay flowers. Odas queue to donate blood for di victims of di massacre.

For Moscow plus oda towns and cities, electronic billboards show di foto of one single candle wey dey burn and di word "Skorbim" - "we mourn."

President Putin don declare Sunday as day of national mourning and e don cancel weekend events across Russia.

Memorials also happun outside Russian embassies for several kontris, including UK.

In a brief statement on Friday, IS tok say na dem dey behind di attack.

On Saturday, dem release one photograph of wetin dem say na di four attackers - all of dem use mask.

Russian authorities neva comment on di claim, wey dey come two weeks afta US warn of a potential attack wey go target "large gatherings" for Moscow.

Russian officials bin complain say di US intelligence lack specific detail.

Eyewitness account of how di attack take happun

Survivors tok of panic inside di building as pipo bin dey try to escape

Wia dis foto come from, Reuters

One security guard describe how di heavily-armed attackers burst into di foyer firing bullets as im alongside im colleagues dey work at di central entrance.

"Three odas security guards dey and dem hide behind one advertising board," e tell Russian telegram channel Baza. "And those attackers pass 10m [30ft] away from us - dem start to dey shoot randomly at pipo on di ground floor."

Inside di auditorium one woman tok say she and oda visitors rush towards di stage, as dem soon realise say shots dey fire. "I see pesin inside di stalls wit sidearm and cracks dey [of gunfire] going off, I dey try to crawl behind one loudspeaker," she tell Russian TV.

Fire and smoke rise into di sky and di hall facade burst into fire as glass on di top two floors of di building blow out.

Map show where di hall dey

Di fire appear to don start wen di attackers throw some kind of device wey fit explode.

One man, Vitaly, describe say e see di attackers opening fire while e bin dey balcony inside di concert theatre: "Dem throw some petrol bombs, everitin start burning. Dem lead us out towards di exit."

Anoda eyewitness say pikin dem and teenagers dey in di complex at di time of di attack, taking part in ballroom dancing competition.

While some of those inside di concert hall escape to di parking area from di stage, odas head to di roof and Russian authorities tok say about 100 more don escape through di basement.

Dem send dozens of ambulance crews immediately to di scene and e stand outside di complex in Krasnogorsk for some time afta di attack.

Massive emergency services operation dey go on for outside of di venue

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Massive emergency services operation dey go on for outside of di venue

Moscow Mayor Sergei Sobyanin respond by cancelling all public events in di capital ova di weekend. "I dey sorry for di loved ones of di victims," e tok.

In di following hours, several oda regions also cancel events, including Russia second biggest city St Petersburg.

Russian Foreign Ministry tok-tok pesin Maria Zakharova call on di international community to condemn di incident, e call am "monstrous crime".

Ukraine goment dey quick to deny any involvement in di attack, wey come more dan two years afta Russia launch full-scale invasion on im neighbour.

"Regardless of everitin, for Ukraine, everitin go dey on di battlefield," presidential adviser Mykhailo Podolyak tok on Telegram.

Only six days ago, Vladimir Putin win im fifth term for di Russian presidential elections. Di vote no include any genuine opponents and Western kontris denounce di elections as e no dey free or fair.

Ukrainian military intelligence tok-tok pesin Andriy Yusov suggest say di attack na "deliberate act of provocation by Putin special services", without offering any evidence.

Rescuers dey work to quench fire for di burning Crocus City Hall

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Rescuers dey work to quench fire for di burning Crocus City Hall

Friday night attack na di worst targeting civilians in Moscow for years, but e bring back memories of theatre siege inside di capital for 2002, wen 40 Chechen militants take more dan 900 pipo hostage during one musical wey dem dey call NordOst.

Russian security services eventually storm di theatre, pumping sleeping gas into di hall. Some 130 hostages die.

Security don tighten di airports and stations.

White House tok-tok pesin John Kirby tok say di the fotos of di shooting dey "horrible and hard to watch".

"Our thoughts obviously dey wit di victims of dis terrible, terrible shooting attack," im tok.