You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Canada reject ova 2 million applications - why dem dey cut temporary residents
Canada wey dey known to be destination to several international students, workers, and visitors, don begin dey tighten dia immigration policy.
Di govment of Canada don introduce plenti immigration policies wey involve how dem wan take cut down di numbers of migrants wey dey enta dia kontri.
According to data from di Immigration, Refugees and Citizenship Canada (IRCC), na about 2.36 million temporary resident applications dem reject for 2024.
Wen Canada bin announce di new immigration plan to reduce numbers of visitor to dia kontri, dem add say na to reduce di pressure wey dey ontop housing, infrastructure and social services.
Also, di immigration plan na 'measures to attract some of di world best and brightest to study and work for Canada, and to make dem join di economy quickly', former Canada minister of Immigration Marc Miller tok bifor e comot office.
Who be dose wey dey affected by di rejection and why Canada dey cut numbers of visitors to dia kontri?
Di application rejection bin affect three categories of visa:
Visitor Visas: Na about 1.95 million applications Canada bin reject for dis category. Dis high pass di previous year wia dem turn away about 40% for 2023.
End of Di one wey oda users dey read well well
Study Permits: About 290,317 international student wey wan study for Canada bin chop rejection for 2024. E still high pass di previous year 2023.
Work Permits: For dis category, dem reject about 115,549 applications.
All applicants wey wan enta Canada wit dis visa bin dey affected sake of di immigration policy for di kontri.
Why Canada dey cut down temporary residents
As di IRCC bin announce, di govment get strategy to reduce di number of temporary residents wey go enta Canada by 2026.
But di question na why Canada dey reduce migrants for dia kontri and how e dey affect dose wey get dream to enta Canada.
- Dem wan control dia population and resources:
Di population of Canada don increase wit temporary residents since afta di Covid period.
According to IRCC, di number of temporary residents add to di population of Canada and e put pressure ontop housing, healthcare, and oda public services.
Na why di Canadian govment sharply respond to di situation as dem unveil di migration policy on temporary residence program.
Pipo wey dey use visitor visas to overstay bin dey shocked wen dem begin dey see harsh cut and rejection rate as applicants dey face serious questioning.
Di study permits receive about 52% refusal rate as govment bin dey hard on di International Student Program.
Canada don complain say close to 50,000 international students wey come dia kontri to study no really dey school.
- Total change to International Student Program
As Canada dey introduce several policies, di international students dey hit by dis new policies to cut down visitors to di kontri.
Reforms wey aim to stabilise Canada education sector dey hit International students hard.
For 2024, IRCC bin set cap for pipo wey wan study for Canada as a way to control di number of international students for di kontri.
Dem also introduce strict measures and eligibility wey go help dem put di policy in control.
Part of di policy na how to stop fraud wit strict verification process.
Also, international students go gatz get financial security through proof of income and dose witout am dey get dia study permits rejected.
Some of dis changes don dey make international students stop to dey eye Canada universities.
- Dem wan prevent overstay
Immigration officials dey prevent overstays for applicants wey get visitor visa.
Dis na becos some of dem no get reasons why dem travel go Canada.
- Dem wan control work permit
Canada dey rely on foreign workers so dem go fit address dia problem of labour shortages for different sectors.
Sectors like health, construction and tourism dey witness high number of applicants, but Canada dey cut down on dem.
Wetin e mean for Canada economy?
Dis rejection of application by Canada go get both positive and negative impact, according to sabi pipo.
Wit di cut down on temporary residents, sabi pipo add say di burden on housing go reduce for Canada.
Dem add say di healthcare sector go also benefit from di cut down, as waiting time go reduce.
On di oda hand, di economic realities and di old population fit make tins change.
But for now, applicants go still dey face tough application processes to enta Canada.