You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Why Lawmakers impeach long-term Lagos Speaker Obasa
Lagos State House of Assembly don impeach dia speaker, Mudashiru Obasa.
Dem remove Obasa wey dey serve im third term as speaker on top accuse of gross misconduct and abuse of office.
Di lawmakers don elect di deputy speaker Madam Mojisola Meranda as di new speaker of Lagos state House of Assembly.
Di impeachment session happun on Monday, 13 January for di assembly chambers for Lagos state, south-west Nigeria.
90 percent of members of di house vote to comot di speaker.
E neva clear di exact misconduct wey di former speaker comot wey lead to im impeachment.
Di Lagos State House of Assembly neva release any official statement on di impeachment, and Obasa neva comment publicly on di mata.
'Our decision to remove am na general' - LSHA member
Di 52-year-old lawmaker, wey dey represent Agege state constituency I, become speaker of di Lagos state house of assembly for 2015.
Obasa don dey di middle of plenty controversial issues, wey include accusations of fraud, political thuggery, and corruption.
Im reign as speaker bin come to an end barely one month afta Lagos state anti-corruption coalition accuse am say e allegedly spend N17 billion to fix one gate wey lead to di assembly.
For one video, one member of di house wey follow tori pipo tok afta dem impeach di speaker tok say di "decision na unanimous".
"Na just change of baton. Na only death dey constant. Change dey inevitable,"
"Di members of di parliament, today, don decide to change di leadership of di house. And di constitution make am clear say di house get di power to regulate dia proceedings.
"So, members of di house feel say we don get enof of Rt. Honourable Mudashiru Obasa; and today, all of us don agree say make Rt. Honourable Mojisola Meranda become di speaker.
"Na resolution wey all members of di parliament agree on and so be it. Honourable Fatai Adebola don become di deputy speaker of di house of assembly.
"And as we speak, all di principal positions don dey dissolved and all standing committees stand dissolved.
"We don agree to work togeda and move di parliament to di next level, we no fit open our eyes and allow di parliament to fail. We owe di constituency and Lagos state a duty to ensure say di sanctity and di integrity of di house dey restored, and dat na why all of us agree to carry out dis action, to save our image and save di state.
Who be Mudashiru Obasa - Former Lagos Assembly Speaker
Mudashiru Obasa na Nigerian lawyer and politician wey don serve as Speaker of di Lagos State House of Assembly since 2015.
Dem born am for Agege, one town for Lagos state, south-west Nigeria on 11 November, 1972.
For 1999, e contest for di seat of councillor for Agege local goment under di Alliance for Democracy Party and e win. E serve between 1999 and 2002.
Dem elect am to di Lagos state house of assembly for 2003 to represent Agege constituency 1.
E serve for numerous committees wey include Committee on Lands and Housing and Physical Planning. For different times, e don serve as Chairman of Committee on Rural Development, House Committee on Public Account for Local Government for six years and Chairman, House Committee on Budget and Economic Planning.
E dey re-elected for 2011, 2015, 2019 and for 2023.
Wetin really lead to im removal neva dey clear, however, for 20 December 2024, di former speaker bin debunk one accuse say di assembly spend N17 billion on assembly gate.
For one statement on Facebook, Obasa describe di allegations as "spurious and funny."
Di Lagos State Anti-Corruption Coalition bin accuse di assembly say dem spend dat kain money to fix gate and dem call for investigation.
Di former speaker bin deny di accuse, and describe am as politically motivated.
"E dey funny. How much be di allocation of di Assembly for a whole year for anyone to claim say we spend ₦17 billion on a gate? Dem even allege say we spend ₦200 million on di recently organised 22nd Thanksgiving service, wey no be true.
"We no say elections for 2027 dey come, those kain baseless claims go arise. E be like say some pipo dey fear, and I no know why" e tok.
Ova di years, e chop accuse say e divert public fund to im personal account plus oda accuse of financial mismanagement within di assembly, allegations wey e deny.
Apart from di money issue, e bin tok some things wey no too sweet some pipo belle.
For 2020, e dey recorded on live TV wen e tok say di Lagos state house of assembly, no go acknowledge di death of miscreants wey police kill for di Endsars protest wey shake di kontri. E tok am as e call for one minute silence for victims of di protest.
Also during di 2023 general elections, many Lagos residents bin dey divided along ethno-political and religious lines. Sake of dat, Obasa bin tok say Lagos state na Yoruba land and no be no man's land as some pipo dey claim.
E say di lawmakers go pass new property and business ownership laws for di state wey go protect di interest of Lagos indigenes.
"Laws go dey for di areas of economy and commerce, property and titles, "and we go reverse all wey dey reversible to protect di interest of di indigenes."
Im most recent comment wey bin generate plenty reactions na on rumours wey dey spread say e wan run as Lagos govnor for 2027.
For im remark during di presentation of di 2025 budget, Obasa clear am say "Becoming govnor na secondary, na something wey im neva give serious consideration. But dat no mean say im dey too young or lack experience to run; whereas, those wey dey bifor him, no dey better of."
Under Obasa leadership as speaker, di assembly bin pass several bills wey go benefit pipo of di state, and some of these bills don dey passed into law.
Dem include, ban on open cattle grazing, Lagos State Neighbourhood Safety Corps (Amendment) Law, 2020, bill to protect witnesses and victims wey get vital information wey fit ensure effective prosecution of cases, Value Added Tax (VAT) bill among odas.
Who be Mojisola Meranda? Di female lawmaker wey replace Obasa as Lagos speaker
Mojisola Meranda na di first female speaker of di Lagos state house of assembly.
She dey elected immediately afta lawmakers unanimously agree to impeach di long-term speaker Mudashiru Obasa on top accuse of misconduct and abuse of office.
Dem born her for August 1980.
For 2015, she bin contest and win di election to represent her constituency for di Lagos State House of Assembly.
For di 8th Assembly, she chair di House Committee on Women Affairs and Poverty Alleviation (WAPA). She also chair di House Committee on Establishment, Training, Pension, and Public Service.
For di 9th Assembly, she serve as di chief whip. Until her emergence as di speaker, she be di deputy speaker of di 10th Assembly