Trump call wit Putin expose lack of consistency on Ukraine peace move

    • Author, Anthony Zurcher
    • Role, North America correspondent
    • Reporting from, Washington DC
  • Read am in 4 mins

Last year, Donald Trump promise say e go end di Ukraine War in "24 hours".

Last week, e tok say e no go end till e follow di Russia President Vladimir Putin tok about am face-to-face.

On Monday, di ground shift again.

Afta Trump follow Putin tok for phone for two hours, e tok say di conditions for peace deal na sometin wey only Russia and Ukraine fit negotiate and maybe di Pope fit help.

Still di US president neva lose im hope say peace fit dey, as im post for social media say di combatants go "immediately start" to negotiate for ceasefire and end to di war.

Dis thinking no dey in line wit wetin Russian view. Putin just tok say im kontri dey readi to work wit Ukraine and create "memorandum on a possible future peace agreement".

Tok-tok about memorandums and "possible future" for peace no really be like di kind of solid ground wey pesin fit build lasting deals.

Putin also chook leg tanda say any resolution wey dem go tok go need to address di "root causes" of di war wey Russia don claim bifor say di war start bicos of how di Ukraine dey try padi-padi to Europe.

On Truth Social afta di call, Trump tok say Russia and Ukraine go "immediately start negotiations" to ceasefire and add say, "di conditions for dat go dey negotiated between di two parties".

But e dey possible say Trump latest take on di war for Ukraine fit be sign say America go fit las-las waka comot di negotiating table.

Later on Monday, Trump tok say e no go comot from arranging tok-tok between di two kontris but tok say e get "red line for im head".

E say, "big egos dey inside, but I tink say sometin go happun, and if e no happun, I go just comot and dem go need to kontinu".

Dat kain waka sef, get im own questions - and risks.

If US comot dia hand from di war as Vice-President JD Vance and Secretary of State Marco Rubio don follow threaten, e mean say US go also end dia military and intelligence support for Ukraine?

And if e happun like dat, e fit be wetin Russia go like as dem get beta resources wen you compare dem to Ukraine wey no get American backing.

Dis mata reach make Ukrainian President Volodomyr Zelensky start to dey fear.

E tok on Monday afta Trump-Putin call say, "e dey important for all of us di United States no comot demselves from di tok-tok and pursuit of peace".

Trump don vex wit both Putin and Zelensky as di work to end di three year kasala still dey go on.

E accuse di Ukrainian leader say dem dey "gamble wit World War Three" for di gbas-gbos meeting wey happun for February for di Oval Office and for April e say e dey "very angry" and "pissed off" wit Putin as tok-tok continue to dey dey jam holdup.

Apart from dis Monday tok-tok, e be like say Ukraine and Russia dey ready to continue some kains toks, and to tok, anyhow e be na progress afta three years of war.

E still remain to see weda di Russian team go dey more than di low level delegation wey go Instanbul to meet wit Ukrainians last Friday.

Trump dey use promise of reduced sanctions for Russia and new trade deals and economic investment to take tantalize Putin wey fit move am towards peace agreement. E tok am again for im post call comments. Wetin dem no disciss na di negative consequences like new sanctions for Russian banking and energy exports.

Di US president last month warn say, e no go tolerate Putin, "tapping me along" and tok say make Russia no dey target civillian areas. But yesterday, Russia launch dia biggest drone strike of di war go Ukrainian cities, and Monday call between di two world leaders show say any ceasefire or peace deal still dey far ahead.