Spain coast guard rescue 86 pipo from migrant boat wey miss ova one week ago

Wia dis foto come from, SALVAMENTO MARITIMO/FACEBOOK
Spanish coast guard don rescue 86 pipo from one boat afta dem begin search for di at least 200 migrants wey dey miss since one week ago.
Di boat wey dem rescue bin dey 130km south-west of Canary Islands, and e carry pipo from sub-Saharan Africa.
Official for Spain say anoda nearby boat bin help dem for di rescue.
Two similar boats wey carry more dozens of pipo still dey miss according to report. Only few details dey available about dem.
Walking Borders, one migrant aid group, tell BBC say na about 65 pipo dey one of di boat and di oda one reach up to 60.
Tori be say dem leave Senegal on 23 June – four days before di bigger boat.
Dis one travel from Kafountine, one coastal town for Senegal wey dey about 1,700km from Tenerife, according Walking Borders.
Di group rescue 80 men and six women. E no clear weda na all di pipo wey dey di boat dem rescue.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di group earlier estimate say di bigger boat bin get 200 pipo on board - including many children - wen e comot from Kafountine on 27 June, heading to di Canary Islands.
Those wey dem rescue include 80 men and six women. E no dey clear weda na all those wey bin dey on board dem rescue.
Di news dey come just weeks afta one overcrowded trawler sink off di Greek coast, inside one of di worst Mediterranean migrant shipwrecks.
At least dem confam say 78 pipo drown, but di UN report say up to 500 still dey miss.
Di waka from West Africa for di Canary Islands be one of di most dangerous waka for pipo wey dey try japa.
One of di reasons be say dem dey usually use fishing boats take waka and di powerful Atlantic currents dey beat those boats up and down as dem no strong.
Last year, at least 559 pipo die for sea wen dem dey try reach di Spanish Islands, na wetin di International Organisation for Migration (IOM) tok. For 2021, na 1,126 pipo die.

But di IOM say informate about di number of waka from West Africa no too dey and dem no dey gree report shipwrecks.
E add say migrants dey normally come from Morocco, Mali, Senegal, di Ivory Coast and oda sub Saharan kontris.
According to Spain Interior Ministry, 15,682 pipo enta di Canary Islands without permission for 2022, wey be 30% less than di number of pipo wey go for 2021.
Di IOM say, "even as di numbers dey reduce year-to-year. di flow for dis dangerous route since 2020 still dey high wen dem compare am to oda years".













