Lawmaker alleged assault of Bolt driver: Wetin be di global package delivery practices?

Wia dis foto come from, Alex Ikwechegh/Facebook
On Sunday, Bolt driver, Stephen Abuwatseya allege say Oga Alex Ikwechegh, a House of representative member assault am and tear im cloth wen e go deliver package to am for im house in Abuja.
Inside one video wey dey spread for social media, di bolt driver request for im money but di lawmaker refuse say im no go pay di driver becos of disrespect.
Oga Ikwechegh insist say e no go pay di driver, and as im dey express im anger e call di business owner to report di delivery man while making threatens say e go "make dis man disappear in di whole Nigeria and notin go happun."
Di lawmaker and driver begin exchange words ova di matta and di lawmaker waka towards di driver, wit sound of phisical attack.
Oga Abuwatseya allege say di lawmaker slap am three times for di video " Are you slapping me sir?"
"You dey look me and tink say you fit beat me? Who do hell you tink you dey follow tok. You sabi who I be?"
Inside di second video, di driver allege say di lawmaker tear im cloth comot from im body "As una dey see I no wear cloth, e don tear my cloth e slap me three times........"
Di lawmaker threaten am make im go report to di police "Call di Inspector General of Police. Call am, make im come here. Record me very well. You come my house, you disrespect me."
Di driver respond say im no disrespect am, make di lawmaker pay am im money so e go fit comot.
Di lawmaker neva tok anytin on di mata since di video come out.
Abuja Police Command arrest lawmaker for assaulting di driver.
Di police tok-tok pesin, Josephine Adeh, confam say Alex Mascot Ikwechegh dey police custody and dem dey kwesion am.
Police say dia investigation show say oga Ikwechegh “physically assault” di bolt driver wey deliver package to Oga Ikwechegh.
“Di FCT Police Command express concern ova Ikwechegh dismissive attitude towards di office of the Inspector General of Police following di incident," di statement tok.
“Currently, di suspect dey di Maitama Police Station undergoing questioning.”
On Monday on X social media platform, Nigeria Police say dem go launch investigation into di alleged assault wey happun between Bolt driver, Stephen Abuwatseya, and Alexander Ikwechegh, for Maitama, Abuja.
Wetin be global delivery practice?
According to DHL, delivery policy recipient must accept dia goods within dia work hours and within dia premises afta di truck arrive
“Recipient must accept delivery of di shipment during standard working hours, immediately afta truck arrival for im premises,”
DHL policy say customer dey responsible for all costs from di delivery and dia agent must ensure say customers accept dia goods.
For Amazon doorstep delivery policy, e allow Amazon agents make dem deliver di goods or item for your doorstep weda or not you dey house but you go include am for your delivery instruction.
"Doorstep deliveries no dey available for buildings wit secure entries or limited access. If we dey unable to access your doorstep, you fit leave instructions wen completing your order on di Preview Order page."

Wia dis foto come from, @alexmascot05/Instagram
Alex Ikwechegh begin im poltical career for 2019 as chairman for Aba North local goment in Abia state at di age of 28. Im kontinu as im seek election as representative for di North and South Federal Constituency.
E hold bachelor degree from University of Calabar wia e graduate wit degree in business management.










