Chef Dammy gbege wit her pastor, her arrest, wetin we know so far

Wia dis foto come from, X/dammypas
- Author, Adesola Ikulajolu
- Role, Journalist, BBC News Pidgin
- Reporting from, Lagos
Ekiti-based Nigerian chef Damilola Adeparusi wey pipo sabi as Chef Dammy don gbege as report reveal say police gbab am for Akure Ondo state for Southwest Nigeria.
Chef Dammy na undergraduate for di Federal University of Oye-Ekiti (Fuoye) wey attempt to cook for 120-hours for June 2023.
Dis na afta Hilda Baci bin make her own attempt wey break di World Guinness Record of longest cooking marathon by an individual, but Chef Dammy tok say she just dey test her own abilities and no be say she wan compete wit Hilda.
Tori be say di church wey Chef Dammy dey attend dat time give her support to do di cook-a-thon attempt wit di help of her pastor Adegoke Jeremiah wey dem dey call ‘Billionaire Dollar Prophet’.
Di bond wey dey between Chef Dammy and her pastor dey very close sake of di cooking attempt.
For one video wey Chef Dammy bin do bifor, she say di money wey dem donate give her neva reach to ‘collect security’ sake of say pipo dey think say she don make plenty money.
For June 2023, Chef Dammy post screenshots of pipo wey send her money - one particular pesin send her one million naira.
How tins fall apart
Di sweet bond between Chef Dammy and her pastor begin dey spoil wen she raise alarm say she dey receive some threats from unknown pipo.
End of Di one wey oda users dey read well well
Twenty-two year old Chef Dammy bin give name of doz wey dey threaten her as ‘people of God.’ She cry out say she don pass through many tins since wen she do di cook-a-thon.
E no long bifor tori comot say pastor Adegoke bin sue Chef Dammy for N20 million. Dis na afta di tori of threats wey Chef Dammy say she bin dey receive.
Wetin happun between Chef Dammy and her pastor no clear but di tori dey gather public attention lately.
For October, Chef Dammy say if anytin do her make pipo hold her pastor responsible as she dey fear say her safety no longer dey sure.
For im reply, di pastor carry petition comot say make Chef Dammy tender apology for di statement wey she make and make she withdraw di statement wit N20,000,000 for damages.
Pastor Adegoke tpk say di statement wey Chef Dammy make na attempt to spoil im image.
Why police arrest Chef Dammy
For Thursday, tori comot say police gbab Chef Dammy for Akure. Details of why dem carry her no dey public but e dey related to di mata wey don dey onground wit her pastor.
Oluyemi Fasipe wey post di mata for X tok say im confam say police bin arrest Chef Dammy sake of di petition wey her pastor bin write against her.
Afta few hours, report comot again say dem grant Chef Dammy bail wey go make her house her house freely.
BBC News Pidgin bin contact di tok tok pesin of di police wey dey incharge of Zone 17 for Akure Adeoye Adeola and im give di side of di police as to wetin really happun.
Also, we send message give di police tok tok pesin for Ondo state Odunlami Ibukun as to why police officers carry Chef Dammy and her whereabout
According to di tok tok pesin of di police wey dey incharge of Zone 17 for Akure Adeoye Akeem Adeola, report say dem arrest Chef Dammy na lie.
E explain say police no arrest Chef Dammy but na she turn in hersef in sake of say we bin invite her ova one petition wey dem receive.
"We no arrest her, una suppose don see di invitation letter for online. We bin invite her via a letter and di invitation dey all ova di media. Na for question sake of say one petition dey against her and we invite her for interrogation."
Akeem add say dem release her on bail on Thursday 23 November 2023 wey be di same day wey she turn hersef in for di police station for questioning.
"We no arrest her, we invite her and we release her afta she finish. Na dat same yesterday we release her on bail comot from our office. She bin turn hersef in to our office sake of di invitation and we release her."















