Inec declare APC Biodun Oyebanji winner of Ekiti govnorshiop election

Wia dis foto come from, Biodun Oyebanji
Inec don declare APC candidate Biodun Oyebanji, winner of di Ekiti govnorship election wey happun on Saturday, 18, June, 2022.
Di APC candidate win 15 out of 16 local goment areas for Ekiti state.
APC lead with 187,057 votes, SDP follow with 82, 211 votes while PDP get 67,457 votes.
Wbo be Biodun Oyebanji?
Biodun Abayomi Oyebanji na public servant wey be 55 years old
- Oyebanji come from Ikogosi-Ekiti for Ekiti.
- Im don serve as Special Assistant (Parliament Affairs) to di Governor of Ekiti State from 8th June 1999-2000 and August 1, 2000 to September 2001.
- Im also serve as Chief of Staff to Governor of Ekiti State between September 2001 to May 29, 2003.
- Oyebanji work as Commissioner, Ministry of Budget, Economic Planning and Service Delivery, Ekiti State from January 10, 2013 to October 16 2014, and also Secretary, Ekiti State Goment 16th October 2018 till December 7, 2021.

Wia dis foto come from, @biodunaoyebanji/TWITTER
Di Ekiti state born politician don tey for politics. E join public service for im 20's as di secretary to di committee wey dem set up for di creation of Ekiti state for 1994.
Oyebanji na former university lecturer before e join politics.
E bin serve as special assistant on legislative matters to di first governor of Ekiti State, Otunba Adeniyi Adebayo, before e later become im Chief of Staff.
End of Di one wey oda users dey read well well
For di first term of di current governor, Kayode Fayemi, Oyebanji serve as di director-general, Office of Transformation, Strategy and Delivery; Commissioner of Integration and Inter-governmental Relations; and Fayemi later appoint am as Commissioner of Budget and Economic Planning.
E don hold oda political offices for di state and e resign as di secretary to di state goment on December 7, 2021 to join di govnorship race.
Dem born di APC governorship candidate for December 21, 1967. E get Bachelor of Science (BSc.) degree in Political Science from di Ondo State University (now Ekiti State University, Ado-Ekiti) for 1989. Masters' Degree in Political Science (International Relations & Strategic Studies) for di University of Ibadan.
Oyebanji dey married to Prof. (Mrs) Oyebanji, wey be associate professor for di University of Ibadan.
How Biodun Oyebanji take win di election

Di Govnors wey don lead Ekiti before
Otunba Niyi Adebayo na di first elected Civilian Governor for di state. Im rule between 29 May, 1999 – 29 May, 2003 under di Alliance for Democracy party (AD).
Ayo Fayose become di next govnor between 29 May, 2003 – 19 October, 2006 under di Peoples’ Democratic Party (PDP) to become di second elected civilian govnor of di State.
Di state assembly later impeach Fayose on October 16 afta e chop accuse of money mago-mago say e embezzle funds, dem later replace am wit di state Speaker Aderemi but federal goment declare say di move dey illegal.
General Tunji Olurin (Rtd) become di state administrator from 19 October, 2006 – 27 April, 2007 under di Peoples’ Democratic Party (PDP) afta dem declare state of emergency for di State.
Chief Tope Ademiluyi become Acting Governor for 27 April, 2007 – 29 May 2007 under di Peoples’ Democratic Party (PDP)

Wia dis foto come from, Other
Engr Segun Oni become Governor for 29 May, 2007 and rule till 17 Feb, 2009 under di flagship of di Peoples’ Democratic Party (PDP) before Appeal court remove am based on illegal returns of April 2007 elections.
INEC later organise a partial re-run of di election.
Rt. Hon. Tunji Odeyemi step in as acting govnor between dis period from 17 February, 2009 – 6 May, 2009 di under Peoples’ Democratic Party (PDP). Im become acting govnor wen one appeal court wey sit for Ilorin, Kwara State nullify Segun Oni election and order rerun poll inside 10 out of di 16 local councils wey dey di State.
Dr. John Kayode Fayemi become govnor of di state for 16 Oct, 2010 – 16 Oct, 2014 under di All Progressive Congress (APC)
Mr. Ayodele Fayose become govnor of di state for di second time for 16 Oct, 2014 – 16 Oct, 2018 under di Peoples’ Democratic Party (PDP)Dr John Kayode Fayemi win Ekiti State election again for 15 July, 2018 to lead di state and im tenure go end for October .












