You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Mass shooting for Michigan university kill three pipo injure odas
At least three pipo don die afta one gunman open fire for Michigan State University, police for di US state tok.
Anoda five pipo also injure for di attack for di main campus for di city of East Lansing late on Monday.
Di police say di suspect don run. Dem describe as "a Black male, shorter in stature".
Di police later say "there is no longer a threat to campus and dem don lift di shelter-in-place.”
Dem add say dem don locate di suspect "off campus".
For some fotos dem release earlier, di suspect bin dey wear one denim jacket, one navy baseball cap and red trainers.
Di shooting bin start shortly afta 20:00 local time on Monday (01:00 GMT Tuesday).
End of Di one wey oda users dey read well well
Police officers respond to di attack, dem see victims for di Berkey Hall on di campus north side, and di adjacent Michigan State University Union building.
For one news briefing, di police say dem get plenti crime locations, and dia investigation dey continue. E neva dey clear wetin be di motive of di attacker.
Plenti ambulance don arrive for di scene as dem don begin treat di pipo wey injure for hospital.
E no dey clear wetin be di motive of di attacker.
Dem don cancel for at least 48 hours. East Lansing lies about 70 miles (112km) north-west of Detroit.