Why school principal resign ontop Michelangelo statue

Dem don force one principal for one Florida school to resign afta one parent complain say students wey dey sixth-grade dey exposed to pornography.
Di complain rise from one Renaissance art lesson wia dem dey show students di Michelangelo's statue of David.
Di iconic statue na one of di most famous for Western history.
But one parent complain say di material dey pornographic and two odas say dem wan know about di class before dem teach dem.
Di 5.17m (17ft) statue show an entirely naked David, di Biblical figure wey kill di giant Goliath.
Di lesson, wey dem dey teach 11 and 12-year-olds, also include references to Michelangelo "Creation of Adam" painting and Botticelli "Birth of Venus".
Principal Hope Carrasaquilla of Tallahassee Classical School say she resign afta di school board give her ultimatum to resign or dem go sack her.
Local media report say Ms Carrasquilla no know why dem ask her to resign, but believe say e dey related to di complaints over di lesson.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dem also say Ms Carrasquilla don be principal for di school for less dan one year.
Inside one interview wit US outlet Slate, di chairman of di school board, Barney Bishop III, say last year di principal send one notice to parents wey warn dem say di students dey go see di Michelangelo David - but dem no do am dis year.
Im say na "egregious mistake" and say "parents dey entitled to know anytime dem wan teach dia children any controversial topic and picture".
"We no go show di full statue of David to kindergartners. We no go show am to second graders. Showing di entire statue of David dey appropriate at some age. We go figure am out wen e go be" Mr Bishop tok.
On Thursday, Govnor of Florida Ron DeSantis, move to expand one law wey ban public schools from teaching sexual education and gender identity.
Teachers wey violate di law fit get suspension or dem fit lose dia teaching licences.
Michelangelo complete di David Statue between 1501 and 1504. Pipo begin hail am sharp sharp as a masterpiece, wit Renaissance artist Giorgio Vasari wey tok say di David "surpass" any statue wey don ever exist before.
Queen Victoria dash one copy of di David to di South Kensington museum - later di V&A - in 1857.
When she first see di cast, di nakedness of di statue shock her well well to di extend wey dem commission fig leaf to cover up di private part.
Di V&A's website say dem keep di leaf "in readiness for any royal visits, wen dem hang am on di figure using two strategically placed hooks."















