Wetin to look out for El Clasico

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Emlyn Begley
- Role, BBC Sport journalist
- Read am in 4 mins
Barcelona and Real Madrid go face each oda on Sunday for late-season El Clasico wey fit get big implications for di title race.
Madrid need to win to strengthen dia hope of giving Carlo Ancelotti a farewell trophy.
Barca go hope say dis na di final Clasico for dia temporary Olympic Stadium home - di Nou Camp dey set to reopen next season.
BBC torchlight some of di talking points.
Title race dey on di line

Barcelona dey lead Real Madrid by four points - dem dey top La Liga table wit four games left.
Barca win go take dem close to di title... but if Madrid win e go really open di title race again.
Two of Barcelona final three games na against teams wey dey for Champions League places - Villarreal at home and Athletic Bilbao away.
Tenth-placed Mallorca na di highest team for table wey Madrid get left to play.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dis season na Barca be di entertainers, dem score 91 La Liga goals - to Real 69.
Dis na Ancelotti last Clasico?
E dey likely say dis go be di final Clasico for di ogbonge Real Madrid boss Carlo Ancelotti.
Di 65-year-old Italian bin dey in charge of Real from 2013 to 2015 bifor im take ova for a second time for 2021.
Ancelotti na di first pesin to lead Madrid to 15 trophies as a manager - including three Champions Leagues and two La Liga titles.
Dis na im final chance to make am 16.
No official announcement yet but tori be say im go step down at di end of di season - probably bifor June Fifa Club World Cup.
Former Liverpool and Real Madrid midfielder Xabi Alonso dey expected to replace am afta im successful spell in charge of Bayer Leverkusen.
Flick fit complete Clasico clean sweep?
Hansi Flick first season in charge of Barcelona dey impressive - including two trophies coming in Clasicos.
Di German fit make am four wins from four Clasicos on Sunday.
Barcelona bin win 4-0 for Bernabeu for di first league meeting of di season for October.
Dem meet again for January for Spanish Super Cup final for January - Barca win 5-2, despite dia goalkeeper Wojciech Szczesny red card for di 56th minute.
And for late April, Barca win 3-2 in extra time for Seville to lift di Copa del Rey.
Who go take centre stage, Yamal or Mbappe?

Wia dis foto come from, Getty Images
Plenty pipo dey tok about Lamine Yamal impact dis season - especially for dia Champions League semi-finals wia dem lose dia tie to Inter Milan.
Di Spain right winger, wey just be 17 years, don set up 21 goals in all competitions for Barca dis season - and score 14 by imsef.
For di three Clasicos dis season, im don score two goals and give two assists.
Mbappe, wey once be di 17-year-old wey di world bin dey tok about, get a similar prolific campaign for im first season for Real Madrid.
Di France captain, now 26, don score 35 goals in all competitions. For La Liga, im dey one goal behind Barcelona Robert Lewandowski - 24 goals to 25 for di Golden Boot race.
Bellingham fit rediscover im golden touch for Clasico?
Last season, wey be im first for Real Madrid, England Jude Bellingham bin be di king of El Clasico.
Madrid win three out of three, including di Spanish Super Cup final, and Bellingham na di hero of both La Liga wins.
For October, Bellingham bin score a 30-yard equaliser and injury-time volley for dia 2-1 win.
And for April im bin score a last-minute winner for dia 3-2 Clasico thriller for Bernabeu.
Dis season im form dey good, im don score 13 goals - but none for El Clasico but na far cry from last season wia im bin score 23-goals to help im team win di title.














