You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Wetin Vardy tok about in future wit Leicester City
- Author, Sean Kearns
- Role, BBC Sport
- Read am in 4 mins
Leicester City captain Jamie Vardy go leave di club for di end of di season but im plan to kotinu to play football.
Im announce di news on Thursday, di Foxes describe Vardy as "dia greatest ever player".
Di 38-year-old striker, wey bin join dem for 2012 from non-league side Fleetwood Town, na di club record Premier League scorer wit 143, and in all competitions im don score 198 goals in 498 appearances.
Vardy bin score 24 times for di 2015-16 Premier League campaign, helping Leicester to win dia first ever top-flight title for dia history.
Di former England international bin also dey part of dia 2021 FA Cup-winning side, wen di Foxes beat Chelsea 1-0 for Wembley.
"To di fans of Leicester, I no dey happy say dis day dey come, but I know e go come eventually," Vardy tok for one video wey Leicester post on social media.
"I spend 13 unbelievable years for dis club, wit lots of success, and some downs, but di majority na highs.
"Time don finally reach for me to say bye -bye, dis no sweet me at all, but I feel say di timing dey right.
"Leicester go always, always get a massive place for my heart."
Im add say: "Dis no be retirement. I want to kotinu to play and do wetin I enjoy most - scoring goals.
"I may be 38 but I still get di desire and ambition to achieve so much more."
Leicester boss Ruud van Nistelrooy say Vardy don stay for dis club "through thick and thin", im add say: "Im don achieve everything and now na to enjoy dis last years wit im family.
"For im next manager, Im be one of di most open and honest pipo wey I don meet.
"Im go tell you how im feel and wetin im dey tink. Im no dey hard to manage."
Vardy describe di club season as "miserable" and a "total embarrassment" afta di Foxes chop relegation earlier dis month.
Leicester dey 19th for table, dem collect 18 points from dia 33 matches.
From di 'great escape' to Premier League glory
Afta im help di club back into di top flight during im second season for Midlands, Vardy become instrumental figure for im side's 'great escape' for di 2014-15 campaign.
Dem bin dey Bottom of di table for Christmas and with just four wins by di start of April, di Foxes bin dey look say dem go return to di Championship.
But 22 points from dia final nine matches help Nigel Pearson side to complete di most unlikely revivals.
If dat bin dey unlikely, den wetin dem do next dey unthinkable
At di start of di season, Leicester wey be 5,000-1 outsiders, go on to win dia first ever top-flight title as dem crown dem Premier League champions for 2015-16 under di management of Claudio Ranieri.
Vardy collect Premier League Player of the Season award afta im score 24 times in 36 appearances, including a record-breaking run wey see score for 11 consecutive league matches – dat record still stand today.
Vardy den go on to score for im side subsequent Champions League campaign and im bin win di Premier League Golden Boot for 2019-20 wit 23 goals.
Di forward become di first player for FA Cup history to appear for 13 of di 14 rounds for di competition wen im play for di 2021 FA Cup final as di Foxes, wey Brendan Rogers bin manage, lift di trophy for di first time for dia history.
Relegation and captaincy
Vardy bin remain wit di Foxes afta dia relegation from Premier League for 2023.
E hit 18 goals in 35 matches for Championship afta Enzo Maresca name am as club captain , e help dem win di title 10 years afta Vardy first promotion with Leicester.
Vardy don feature for 31 of di east Midlands club's 33 Premier League matches dis term, scoring seven times.
Im final game for di King Power Stadium go be on 18 May, wen di Foxes go host Ipswich.