Ghana Attorney general dey pursue 12 national service secretariat officials ova $53m 'ghost names scandal'

former directors of NSS

Wia dis foto come from, GIFTY OWARE-ABOAGYE/MUSTAPHA USIF/OSEI ASIBEY ANTWI/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Di three former executive directors chop accuse togeda wit 9 oda pipo ova di ghost name scandal wey cost di kontri $53m
Read am in 6 mins

Di Attorney general of Ghana don tok say im office don finish investigation into wetin im describe as 'ghost names' scandal for di kontri National service secretariat (NSS).

Dis na di latest for di goment Operation Recovery All Loot (ORAL) agenda wey dey target to collect all moni and properties wia former goment appointees don tiff.

For one press conference on Friday, di attorney general Dr Dominic Ayine tok say dia investigation don find say 12 officials of di secretariat don cause financial loss to di state of ova Ghc 548m ($53m) thru ghost names wia dem put on top di payroll.

Di national service secretariat dey in charge of posting tertiary students to various state agencies and ministries afta dem finish dia tertiary education, for one year.

Di secretariat bin dey post ova 150,000 graduates from di various public tertiary institutions every year across di kontri.

the three former NSS bosses

Wia dis foto come from, GHANA NATIONAL SERVICE AUTHORITY/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Di Attorney general say im go charge dem (Gifty - L- Mustpha - M- Osei Asibey - R) wit stealing, conspiracy to steal, money laundering, using public office for profit, causing financial loss to di state among odas

During di one year period, di kontri dey pay dem monthly allowance of Ghc 715 ($70) bifor na ibi Ghc 559 ($54).

Na so some of di authorities in charge for di secretariat bin dey allegedly add thousands of ghost names to di payroll, according to di attorney general.

"We don find say dis officials for di NSS bin use dis ghosts names and oda vendors to siphon millions of money from di state," Dr Ayine explain.

Im add say "for some of di cases di officials create companies wia dem use as vendors to collect di execess moni for dia own business."

So far, di Attorney general tok say dem dey treat di 12 officials as suspects for dis mata.

Dem include di former executive director for di national service secretariat Mustapha Yusif (wia later become di kontri sports minister), Osei Asibey Antwi (di last executive director for di NSS) and Gifty Oware (di deputy executive director for di service) bifor di former goment tenure don end.

Di oda pipo na "staff of di secretariat and managers of some of di third-party vendors wia don create criminal enterprise to misappropriate state funds for dia personal profit."

According to di attorney general, some of di officers don gree wit im office to serve as witness for di trial for court.

Dis na di amount of moni wia don allegedly loss each year since 2018

gifty

Wia dis foto come from, GIFTY OWARE-ABOAGYE/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Madam Gifty Oware Mensah na di former deputy executive director for di national service secretariat wey she also be football administrator

- 2018/2019 - Ghc 26m ($2.5m)

- 2019/2020 - Ghc 22m ($2.1m)

- 2020/2021 - Ghc 56m ($5.4m)

- 2021/2022- Ghc 61m ($6m)

- 2022/2023 - Ghc 351m ($34m)

- 2023/2024 - Ghc 33m ($3.2m)

In total, di money wia di state don loss na Ghc548m ($53m)

Di kontris National investigations bureau (NIB) and di police CID togeda wit investigators for di attorney general office bin dey investigate dis mata for ova four months.

Dem don freeze di bank accounts of some of dis officials during di investigations.

FORMER NSS executive director

Wia dis foto come from, GHANA NATIONAL SERVICE AUTHORITY/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, According to di attorney general, some of di officers don gree wit im office to serve as witness for di trial for court.

List of NSS officials and odas wia dem dem go put for court

  • Mustapha Usif - Former executive director
  • Osei Asibey Antwi - Former executive director
  • Gifty Oware Mensah - Former deputy executive director
  • Ohene Gyan - Former deputy director (operations)
  • Abraham Bismark Gaisie - Former internal auditor
  • Kwaku Agyei - Accounts officer
  • Iddrisu Abubakar - Former head of accounts
  • Stephen Gyamfi - Koforidua NSA director
  • Prince Awuku (District director)
  • Jacob Yawson (MIS administrator - Northern region)

Two oda suspects dey among di list but di attorney general tok say dem still dey conclude investigations about dis two, bifor dem go publish dia names.

Mustapha Usif

Wia dis foto come from, MINISTRY OF SPORTS

Wetin we call dis foto, Oga Mustapha Usif togeda wit Osei Asibey bin deny say dem tiff di kontri moni for one press release in February dis year

Wetin go be di charges against dis 12 pipo

Di attorney general Dr Dominic Ayine tok say dem go formally file criminal charges against dis officials.

  • Stealing
  • Conspiracy to steal
  • Causing financial loss to di state
  • Using public office for profit
  • Obtaining public property by false declaration
  • Money laundering
  • Conspiracy to commit money laundering

For February dis year, two of di 12 officials of di national service secretariat wia di attorney general describe as suspects, bin release statement afta one media house investigation project "The fourth estate" don publish dia findings of investigation wey show ova 80,000 alleged ghost names on top di national service payroll.

Dis two officers - oga Mustapha Usif and Osei Asibey Antwi bin tok say dem no do anytin wrong.

"Throughout our tenure we don dey committed to implementing robust enrolment and verification systems to reduce attempts by bad pipo to enter di system," di two former executive directors tok.

Dem add say "make di public no mind wetin di fourth estate bin publish about ghost names for di payroll. Dem don misunderstand di data and di process of di NSS wia fit lead to pipo thinking say bad tins happun for di secretariat."

For dat statement on 18 February, dem add say "we welcome di directive by President John Mahama say make dem investigate di mata; dat be wetin go show say we no do anytin wrong."

john mahama hands over oral report to attorney general

Wia dis foto come from, PRESIDENCY OF GHANA

Wetin we call dis foto, President John Mahama don give instructions to di attorney general say make im investigate and prosecute all former appointees wey bin allegedly tiff di kontri moni

Afta di latest press conference wia di attorney general announce say im go charge dem wit seven counts, dem no respond yet.

Pipo bin dey ask why di attorney general dey do press conference to announce wetin dem find from dia investigation about ogbonge cases, Dr Dominic Ayine explain say im no do anytin wrong.

"For di US and oda democracies for di world, dia investigators and attorneys bin dey address press conference every time to give update to di kontri about corruption cases dem dey pursue. Na so I go kontinu."

For di last two months, di attorney general don charge four former appointees of di Nana Akufo-Addo goment wia dem allegedly cause financial loss to di state.

Former signals bureau boss Kwabena Adu-Boahene and im wife dey stand trial for di court say dem cause financial loss to di state.

Two odas, di oga for di Ghana infrastructure and investment fund (GIIF) and di board chairman of di fund don dey stand trial ova a $2m sky train scandal.

For dis two cases, di attorney general don address di press bifor im enta court wey im charge dem with separate counts.