'I dey pregnant at 40 afta two failed IVF' - Toke Makinwa

Read am in 6 mins

Following di video of her baby bump wey she take announce her pregnancy on Wednesday, popular media personality Toke Makinwa don open up more about her journey say she bin go through two failed IVF bifor dis one work out for her.

For her Vlog wit Toke Moments on YouTube on Thursday, 14 August, di popular media personality and entrepreneur bin carry her fans through di journey of how God fulfil her greatest desire – wey be to become mama.

Ms Makinwa wey pipo sabi well as Toke tok say one of her greatest wish wen she dey about to turn 40-years-old na to become a mother and marriage, but e no work out as she wish.

She say to achieve dis desire, she do many tins wey she neva do bifor. "I join Halleluyah Challenge, I don do am bifor, I do am again wit faith. I sowed, I do tins wey I neva do bifor, I take sometin wey dey precious to me and I sow am to Halleluyah challenge. My own journey don become transactional wit God, I go through di year trying to become a mom, I try twice and e no hapun. I launch TM beauty for di middle of depression. I dey laugh, dey jump, but my soul dey empty."

She say afta di second IVF fail, she bin enta depression, she stop to dey pray and she cancel all di plans for her 40th birthday and she throw hersef into work.

"I dey live for Abuja at di time but I dey shoot BBNaija for Lagos. I go work all through di week for Abuja, for Friday, I go take flight go Lagos and pipo begin wonder if I dey owe house rent."

Di media personality say she bin give up on life and at one point, she bin wish to die. "I tell God to call me home. I don try, wit my small life, I don achieve tins wey me sef no ever believe say I fit achieve." Wetin pipo dey see outside na successful career lady, pesin wey get evrytin togeda, but wetin pipo no know be say, she dey empty."

Turning point

Toke say her turning point na one day wen she hear one voice wen she dey her room, "Time na concept wey I own and you no fit wrestle am out of me." She say wen she hear dat word, she know say na God speak to her. She find hersef begin dey pray again, and tell God say I no wan dey transactional relationship wit you, I just wan serve you, live life and be happy.

She begin plan her birthday again and do dat thanksgiving service wey everybody see. Di thanksgiving suppose be announcement say she dey expect her baby, but wen e no hapun, she still thank God.

For October, her doctor say make she try again. She bin get doubt but she make up her mind say whatever di outcome be, she no go dey sad.

For November, doctor give her di good news, at di age of 40, one month afta her birthday as she desire am.

Toke Makinwa say being pregnant at 40 na 'di biggest project of my life'

Plenty congratulations bin don dey enta for Nigeria media personality Toke Makinwa, afta she announce say she dey expect her first child.

Di 40-year-old popular radio and television host wey post video of her baby bump on top her Instagram account on Wednesday, 13 August say dis na, "di biggest project of my life, di highest calling ever!"

Popular Nigerian celebrities and plenty ogbonge Nigerians wey include Funke Akindele, Kemi Adetiba, Iyabo Ojo, Falzthebadguy, and plenty odas dey among those wey first congratulate her.

Di popular social media personality wey reflect on how di journey to be a mother take start say, dis na her prophetic declaration as she enta year 2025. She add say di pregnancy na testimony of God perfect timing.

For di post wey she take unveil her pregnancy, Toke wey dey emotional for her write up tok say pipo don know her as many tins, but now dem go see her as a mother.

"I don wear so many hats ova di years but dis one top evrytin and I dey so humbled to dey chosen. You guys dey wit me from di start, di girl you meet on radio, di brand you don support all dis years, dis victory na major. You get to see me as a Mother, I get to raise my own. Na me be this????? Hallelujah!!!!!!!!!!!!!!!!"

Toke wey in di past don tok how she wish to be mother and even say she dey reason surrogacy, express her joy, and say she no fit wait to see her baby.

"My bug, I no fit wait to meet you, you don make me di happiest pesin on earth baby, thank you. Thank you for choosing me to come through life to be di greatest reflection of God's grace. Di answer to my prayers, dis whole journey don give me life, you don bless already. My heart dey ova di moon." She write.

Who be Toke Makinwa

Ms Makinwa wey pipo sabi well-well as Toke na pesin of many parts. Ova di years, pipo don know her as television host, actress, brand influencer, Vlogger, businesswoman, author and as a radio presenter.

Toke wey bin don work for several radio stations say she gain popularity for 2014 as di host of one radio morning show programme for Rhythm FM.

She rise from being a radio host to become one of di most influential female voices for Africa media, as she hold her space for di entertainment and fashion sector.

Toke na pesin wey no dey shy to tok about her background, her life and her career. For one interview wit media personality, Chude Udenwo, Toke bin tok about how she lost her parents early, di crash of her marriage, her book - On Becoming and how she take bounce back.

Dem born Toke for November 1984 for Lagos Nigeria. She tragically lose her both parents for one house fire accident wen she still dey young. Na guardians raise her and her siblings.

She get her first degree from di University of Lagos.

For 2014, Toke marry fitness coach and entrepreneur Maje Ayida. However, di marriage end for one highly publicised divorce for 2016, following revelations of alleged cheatings. She write di tori of her marriage, and di heartbreaks for one book, On Becoming.

For one interview wit BBC Focus Africa, she say di book tok about her pain, healing and transformation.