You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Ceasefire dey end war?
Tori be say Israel Prime Minister Benjamin Netanyahu bin dey discuss di latest proposals for peace wit Hamas wit im security cabinet.
But ceasefire fit end di fight-fight for Gaza permanently, or na only for some time?
Wetin ceasefire mean?
According to UN, "ceasefire" no get any single, universally accepted definition of di word, although di word come from di military order to "cease fire", wey be di opposite of di order to "open fire".
For di two parties wey dey at war, e fit mean anytin dem take am to be during dia negotiation.
Dem also dey switch am wit dis words "truce" and "armistice".
But UN say difference dey between di terms "ceasefire" and "cessation of hostilities".
Dem say "cessation of hostilities" dey like informal agreement to stop di fight-fight.
While "Ceasefire" dey more formal, dem add say dem dey mark am wit agreement wey go carry details like:
- di koko of di ceasefire
- di political process wey go follow am
- wen e go come into effect
- di geographical area e go cover
End of Di one wey oda users dey read well well
E fit also no spell out di kain military activities wey go dey allowed and di one dem no go allow, and how di ceasefire go dey monitored.
For example, Liberia civil war end for 1993 wen di Interim Goment of National Unity do deal wit di National Patriotic Front of Liberia and di United Liberation Movement of Liberia for Democracy.
Both sides agree to stop to import arms and ammunition, dem agree not to alter or attack military positions, not to incite further hostilities and not to use mines and incendiary devices.
Ceasefire na permanent ting or only temporary?
E fit be di two, UN tok.
Sometimes, di two opposing sides for di war go agree to a temporary, or preliminary, ceasefire.
Dis fit reduce violence or alleviate a humanitarian crisis.
Wen Israel and Hamas-led militant groups bin agree a temporary ceasefire, wey bin take place between 24 November and 30 November 2023, Hamas bin release 105 hostages in exchange for some 240 prisoners.
Dem fit also agree a preliminary ceasefire to create environment wey go help negotiations and help lay out a path for a permanent, or a definitive, ceasefire.
For June 2000, Ethiopia and Eritrea bin sign agreement to freeze di conflict so dem go fit negotiate a definitive ceasefire. Dem bin sign dat agreement for December, as part of di Algiers Agreement wey end dia war.
However, war fit continue becos of series of failures, or fragile, preliminary ceasefires.
Di United Nations (UN) bin negotiate a series of ceasefires to try to end di civil war for Lebanon – for 1978, 1981 and 1982. but, fight-fight flare up afta each one and di war, wey bin start for 1975, only end for 1990.
In some cases, one or both of di kontris wey dey at war fit wan use di preliminary ceasefire to strengthen dia positions for ground.
A definitive (or permanent) ceasefire usually dey come afta several successful peace toks between di kontris wey dey at war.
Normally e dey involve di disarmament or demobilisation of identified forces, but di follow-on security arrangements fit still remain in place for many years afta dem sign di agreement.
For example, di1998 Good Friday Agreement for Northern Ireland bin involve di Provisional IRA and loyalist groups wey bin agree to put dia weapons "beyond use".
Di agreement bin also contain clauses wey bin intend to promote ongoing peace and harmony for di province, like keeping di border between Northern Ireland and di Republic of Ireland open for frictionless, tariff-free trade.
Which kain limited ceasefire dey?
Israel and Hamas bin call dia temporary ceasefire for November 2023 "humanitarian pause".
Sometimes dem dey use humanitarian pauses to reduce di violence of di fighting or to alleviate humanitarian crisis.
For example, di goment of Sudan bin agree a ceasefire wit two militant groups, di Sudan Liberation Movement and di Justice and Equality Movement, wey bin stop di fight-fight for Darfur for 45 days to allow agencies to deliver humanitarian aid to local pipo.
For 2004, afta di tsunami wey land for Indonesia, both di Indonesian goment and di Free Aceh Movement bin declare ceasefires so dem go fit deliver aid for di areas wey fight-fight bin dey happun.
Dem fit also agree to stop di fighting for a particular area, dat one dem dey call am geographical ceasefire.
For 2018, di UN bin cut deal between di goment of Yemen and di Houthis to stop fighting around di Red Sea port of Hodeida to protect di local population.