Ondo State assembly confam Olayide Adelami from Akeredolu hometown as deputy govnor

Ondo govnor and deputy

Wia dis foto come from, Lucky Aiyedatiwa/Olayide Adelami

Wetin we call dis foto, Chief Olayide Adelami na from Owo

Di Ondo State House of Assembly don confam Dr Olayide Adelami as deputy govnor of di state.

Di screening bin take place on Wednesday for di assembly complex wey Speaker Olamide Oladiji bin preside ova.

Govnor Lucky Aiyedatiwa bin forward nomination letter go di state assembly on Wednesday bifor di honourable quickly meet to screen di deputy govnor nominee.

Deputy Speaker Abayomi Akinruntan wey read di letter say di nominee na man wey dem don confam to get good character and e dey fit for di position of di deputy govnor.

Wen di state assembly confam di nomination of Olayide Adelami as deputy govnor, some well-wishers wey dey di assembly sitting begin dey hail am.

As di newly sworn-in deputy govnor bin get chance to tok, e first tank Govnor Aiyedatiwa wey nominate am for dis kain opportunity to be di second citizen for di state.

Deputy Govnor Adelami add say im go use di new office to serve di pipo of di state make development for come Ondo State.

Dr Adelami wey hail from Owo, di hometown of late Rotimi Akeredolu, na politician wey don formerly aspire to be govnor of di state during di 2020 election for Ondo State.

During di primaries of di All Progressives Congress (APC) for 2020, Dr Adelami later join hand wit Akeredolu and Aiyedatiwa ticket to win di govnorship election.

Who be Olayide Adelami wey Lucky Aiyedatiwa name as deputy govnor for Ondo State

On Wednesday, Ondo State Govnor Lucky Aiyedatiwa bin nominate Chief Olayide Adelami as deputy govnor for di state.

Dis na few hours afta im announce di dissolution of im cabinet members same day.

Reports from local media tok say Chief Olayide Adelami na from Owo, same hometown and local goment wey di late govnor Rotimi Akeredolu bin come from.

Chief Adelami na former deputy clerk of di National Assembly. Na April 2018 im retire. Im bin also contest wit di late govnor Akeredolu for di 2020 primary election under di All Progressives Congress (APC).

Di Ondo State House of Assembly don receive di name of di new nominee for di position of di deputy govnor.

Di nominee come appear bifor di state assembly on Thursday 25 January 2024 for screening afta di speaker of di House Rt. Hon. Olamide Oladiji bin receive di letter a day bifor.

Lucky Aiyedatiwa dissolve cabinet members

Di govnor of Ondo State Lucky Aiyedatiwa don dissolve all members of di executive council wey dey di state.

Dis announcement comot at di early hour on Wednesday wen di govnor bin write through im chief press secretary Ebenezer Adeniyan.

Govnor Aiyedatiwa also add say di dissolution na wit immediate effect and make di affected officials go drop all goment documents wey dey dia hand to di permanent secretary.

“Make all members for di cabinet go hand ova to di permanent secretaries or di most senior administrative officers wey dey dia respective offices,” govnor Aiyedatiwa tok.

For di state, even all di senior special assistants and special assistants dey “relieved of dia duties wit immediate effect”.

“All di affected officials dey directed to hand ova all goment properties for dia possession,” di statement tok.

Wit dis dissolution, di govnor dey expected to appoint new cabinet members wey go work wit am for im administration.

Remember say some senior special assistant, special assistants and commissioner bin resign wen di late Rotimi Akeredolu bin comot for dis world sake of illness.

Akeredolu bin die afta im battle wit cancer afta im don receive treatment for Germany bifor dem carry am come back Nigeria.

Di 67-year-old bin spend several months on medical leave before e return come Nigeria sake of im health for September 2023.

As di state House of Assembly don swear-in Aiyedatiwa as govnor for December 27 2023, di big search and expectation na who go become di new deputy.

Di govnor dey expected to announce im new cabinet anytime soon as plenti expectations don dey for who go make di new list of appointments.