Names, faces of all 40 victims wey die for Owo attack

Grief and emotions flow for Owo town dis morning as mass funeral hold for victims of di church attack wey happun on Sunday June 5, 2022.

Ondo State govnor, Rotimi Akeredolu join di friends and families of di victims wey die on Friday for di funeral service.

Di church service go dey followed by di mass interment of di victims.

And tori be say dem dey plan to make di area for di burial memorial centre.

BBC Pidgin don gada a list of names and faces of all 40 victims wey die for di attack.

During di mass burial rites for di grave site, some families bin insist on taking dia relatives corpses to go bury.

See di victims for Owo

Gunmen wey dey suspected to be terrorists storm di Catholic Church come kill 40 worshippers and injure several odas.

Di National Security Council don accuse fighters of Islamic State West Africa Province (ISWAP) say na dem of launch di attack.

Authorities never arrest anybody wey dey in connection with di attack.

Here be a compiled list of di victims:

Police tok wetin preliminary investigation show

Ondo State police command for dia preliminary investigation reveal say, "di assailants approach di church during service on 5th June.

Dem “come begin shoot from outside di church while odas wey reach four in number shoot directly into di church".

Odunlami Funmilayo wey be di state tok-tok pesin add say:

"Di state police commissioner don order immediate deployment of armed and specialised policemen to di area to restore normalcy and fortify di entire community."

Meanwhile, di Police Commissioner don also order forensic investigation into di attack.

List of those wey get injuries

Apart from those wey die, goment on Friday release list of those wey get wounds.

Owo mass burial pictures

Who dey responsible for di attack?

Nigerian authorities say dem suspect say na di extremist group Islamic State West Africa Province carry out di deadly attack.

Nigeria Interior Minister Rauf Aregbesola disclose dis one afta one security council meeting wey President Muhammadu Buhari chair for di presidential palace for Abuja.

But no group don claim responsibility for di attack on St Francis Catholic church for Owo, Ondo state

If e dey confamed, e go be di first attack by di IS-linked militants for southern Nigeria - e signify how di violence don expand.

Di group dey mainly operate for di north of di kontri.