Israeli military say dem kill Hezbollah leader Hassan Nasrallah afta multiple blasts rock Beirut

Read am in 5 mins

Di Israel Defense Forces (IDF) say dem don kill Hezbollah leader Hassan Nasrallah afta di overnight strike wey happun for Beirut.

Israeli military tok say dem target Hezbollah central headquarters for Beirut southern suburbs on Friday, 27 September, for one attack wey shake di Lebanese capital and send thick clouds of smoke ova di city.

Dem add say Hezbollah leaders and commanders na dia target for di attack wey dem carry out.

For statement wey IDF bin share for dia X account, e say: "Hassan Nasrallah no go fit dey able to terrorize di world."

Israeli media bin don alreadi report say Hezbollah leader Hassan Nasrallah na di target of dis attack on di group stronghold for southern Beirut.

But Hezbollah sources bin tell various news organisations - including AFP, Reuters and local media for Lebanon and Iran - say Nasrallah dey alive and safe afta di strikes for di Dahieh suburb.

Hezbollah don confam dia leader status say e don die.

Di multiple strikes take place veri close to one school wia displaced pipo from di south of Lebanon dey take refuge.

Di Israeli military say di headquarters dey located "under residential buildings" for di Dahieh suburb for di city south.

How di multiple blasts rock Beirut for Hezbollah headquarters

At di beginning, evri one bin tink say na strong sonic boom as a result of Israeli jets breaking di sound barrier.

But den di sounds of explosions continue, round afta round.

Pipo bin rush out of di building in fear. Women and children bin dey scream and cry. Some pipo bin faint and fall for ground.

Di man in charge of civil defence bin dey try to calm pipo down, and tok say na just sonic booms.

But soon, thick smoke begin rise from one area behind di building from di series of air strikes.

IDF tok-tok pesin Rear Admiral Daniel Hagari tok inside one video statement say di HQ dey "intentionally built under residential buildings" for di city southern Dahieh area "as part of Hezbollah strategy of using Lebanese pipo as human shields".

"Israel dey do wetin evri sovereign state for di world go do if dem get terror organisation wey dey seek dia destruction on dia border, taking di necessary action to protect our pipo so dat Israeli families fit live for dia homes, safely and securely,” e add.

Ambulances try to get to di scenes and nearby roads nearly dey packed wit pipo wey dey carry rucksacks and bags, as dem dey try run comot from Dahieh.

More fotos from di attack

Netanyahu go cut short im US trip and return to Israel

Di office of Israel Prime Minister Benjamin Netanyahu, tok say di leader go cut short im trip to di US and return to Israel tonight.

Im bin dey New York to address di UN General Assembly earlier for one speech wey no mention ceasefire.

Earlier dis evening, Netanyahu office also release one foto wey dem tok say show am dey approve di Beirut strike from im hotel room.

Two pipo don die and 76 injure so far, Lebanese health ministry tok

Lebanon health ministry don tok say two pipo don die sake of di attack on Dahieh.

Dem add 76 pipo don injure, and 15 of dem need hospital treatment.

But di ministry warn say dis na initial death toll, as rescue operations and di removal of rubble for di site of di attack for southern Beirut still dey go on - so dem expect say di number of dose wey die and wound "go rise in di coming hours".

Israeli defence minister watch latest strike from air force HQ

Di Israeli defence minister tok say im "closely follow" di latest strike on Beirut from Israel air force headquarters.

Yoav Gallant say Israel go "continue to hit Hezbollah evriwia, at any time until di residents of di north return home safely".

Gallant watch di strike as dem carry am out for di southern Beirut suburb of Dahieh, alongside senior members of di Israel Defense Forces (IDF).

One IDF statement say Gallant go receive "ongoing operational updates".

British citizens 'gatz leave now', foreign office tok

In di past hour, di UK Foreign Office don release statement wey urge all British citizens for Lebanon to "leave now".

"You gatz take di next available flight," di office tok.

Dem add say dem dey work to "increase capacity and secure seats" on commercial flights out of Lebanon.

Di foreign office also request British citizens wey dey live for Lebanon to register wit dem so di latest information fit dey shared.