How fans dey celebrate Anthony Joshua as e beat Jermaine Franklin

Hashtag congratulations AJ dey trend for Nigeria social media as di Nigerian-British Heavy weight champion secure di 25th win of im career as e beat Jermaine Franklin on Saturday.

Anthony Joshua return to winning ways wit undisputed points victory ova Jermaine Franklin for London O2 Arena.

Di 33-year-old Nigerian-British heavyweight, bin control di contest against di professional but e no be di explosive early finish many bin dey expect.

Two judges score am 117-111 and one 118-111 to Joshua.

Former Nigeria Senate President, Bukola Saraki join oda world pipo to hail di heavyweight champion on im win.

Tempers bin go high afta di final bell as di two fighters begin para for each oda, dis make dia teams enta di ring and security later separate dem.

Dis na Joshua first win in more dan two years, afta e lose back to back two times to WBA (Super), IBF and WBO world champion Oleksandr Usyk.

"No knockout, so e no good. Na brutal sport, but knockouts be everything. I no dey too happy," Joshua tell 5 Live Boxing.

"I for don throw more shots, and I for do am, no excuses. But I will. Dat na part of coming back; you gatz be your own biggest critic."

E also call out im fellow Briton and WBC champion Tyson Fury, say: "I try and provide for di fans. I know wetin dem want. Dem say Tyson Fury – di ball dey im court."

Joshua now don win 25 fights, wit 22 stoppages, and don lose three since e turn professional for 2013.

How di fight take happun for di arena

Joshua return to di O2 Arena - for di Watford fighter - afta seven years. Im seven previous fights for di venue ended inside the distance, but this was not vintage Joshua.

Joshua bin start strongly, e take di centre of di ring and dey double di blow to pierce Franklin guard, wit quick feet to stay out of range of any advances. A thudding straight right get Franklin attention for di start of di second.

Di Michigan fighter - wey shed 23lbs since e lose to Whyte – bin come out strong for di third, e grow confidence and show say im no dey there to make up di numbers.

Joshua land correct uppercut from range for di fourth and both men get success for di fifth.

Boxing fans and pundits bin feel say Joshua gatz win in style against a fringe world-level contender. Even 'AJ' himself tok say im gatz make statement, but e come begin look like say dat no go be di case.

Franklin begin tire as dem start di second half of di fight, Joshua land am one sharp hook on di inside.

Joshua enjoy more success for di next round, as e land Franklin terrific uppercut. E laugh and, perhaps for di first time for di fight, di former unified heavyweight champion dey reminded of im old self.

Joshua wey be like say im don try well-well dey reminded of di danger wey Franklin pose, as e take a couple of clean shots, but out-jabbed im opponent, wey continue to clinch, for di final rounds.

For scenes wey resemble di outburst e do wen e lose to Ukranian Usyk for August, Joshua once again allow im frustration to get di beta of him afta di final bell.

E tap Franklin on di back of di head, wey react and then AJ decide to wrestle wit im opponent, before Franklin corner join. Di fight continue outside di ring, as dem push back di barriers wey separate di teams from media.

"Last time wey I grab di mic, e dey messy," Joshua tok afterwards. "I dey calm - I appreciate everybody wey come out dis evening.

"Inside di ring, na different energy so I apologise to those wey dey watch."

Fury go be di next?

Fans bin wan see di return of di old Joshua. Di ferocious, ruthless combination puncher wey stop im first 20 opponents inside di distance.

But di last time Joshua win for di first half of a fight na for 2016, against Eric Molina. Perhaps dat na testament to di level of opponents e don face since then.

Franklin - na fringe world level contender – e give Joshua a harder night work dan wetin most pipo expect. Nevertheless, pressure dey. If to say Joshua lose, e for dey hard for am to come back.

Despite an underwhelming performance, Joshua dey ready for a match-up wit Fury.

"I go dey honoured to fight for di WBC heavyweight championship of di world," Joshua tok.

"If e dey listen, e sabi my promoter, we don tok before, so make we continue dis. We don dey old."

Unbeaten Fury last outing na trilogy bout win over Derek Chisora in December. Di Morecambe fighter go dey look for high-profile opponent for im next fight.

Joshua-Fury na arguably di most lucrative bout for both men. In terms of appeasing fans, e go go a long way in getting back some credibility for di sport afta an undisputed fight between Fury and Usyk come through.