Which Lagos law Sarah Martins break during her cooking for Lekki

Wia dis foto come from, Tokunbo Wahab/Lagos Ministry of environment
Authorities for Lagos say dem gbab one 'street trader' wey bin dey cook and sell for public for Lekki, but di woman wey later identify as Sarah Martins say she no dey cook to sell.
Operatives of di Lagos State Environmental Sanitation Corps wey also dey known KAI say dem arrest di 'street trader' on Thursday 16 October 2025, sake of say she bin dey cook and sell for Admiralty Way Lekki.
Wen di KAI officers bin reach dia, dem find di woman dey cook give pipo. Dem carry her cooking pan, and some oda items wey she bin dey use cook.
Di scene cause several oda pipo to come look wetin dey happun as she dey para while di officers dey pack her tins comot.
Sarah Martins na di woman wey di KAI operatives bin carry her cooking tins comot for wia she dey cook for public.
She say she no be chef and wetin she dey cook na for homeless pipo she dey do am for, bifor KAI officers scatta her tins.
Howeva, Lagos State Ministry of the Environment and Water Resources through di commissioner, Tokunbo Wahab, e say di woman allegedly violate safety rules and enviromental regulations.
Which law Sarah Martins break?
Di ministry of environment say Sarah Martins engage in 'unauthorized activities on public infrastructure.'
According to statement by commissioner Wahab, her cooking activities for road go against di Lagos state regulations.
"Di individual wey dey in kwesion bin claim say she dey do charitable cooking activities for di road median, wey unfortunately dey against existing environmental and sanitation regulations."
"Dat kain initiative gatz happun in compliance wit di state extant laws to ensure public safety, environmental protection, and urban order."
Di commissioner say Lagos State govment appreciate di spirit of philanthropy and community support wey pipo like Sarah Martins dey do, but dem gatz do am in line wit di rules and regulations of di state.
"Unauthorized use of public spaces, such as road medians, for commercial or personal activities get significant risks, including damage to infrastructure, health hazards, and disruption to traffic flow."
Environment ministry say dem gatz comot Sarah so dem go fit keep to dia campaign wey dey focus on clean Lagos.
"Our enforcement actions wey include di arrest and removal of equipment for dis case, na part of di Keep Lagos Clean and Zero Tolerance Lagos campaigns wey dey focus to preserve di city aesthetic and functional integrity."
Di ministry say anybodi wey wan use public spaces make dem seek approval bifor dem use am, even if na for charitable purpose.
Sarah Martins react
Meanwhile, Sarah Martins wey her full name na Chukwukere Sarah Ujunwa na actress wey pipo sabi for Nollywood, tok say she be philanthropist wey dey help vulnerable and homeless pipo.
According to her own account of di incident, she say di officer of KAI bin bully her and carry di food wey she bin dey cook comot wit evritin wey she dey use.
For wetin she bin post for Instagram and di video wey she add, she say di men wey come bin show up in uniform wey she bin dey cook for homeless pipo for 'di streets of Lagos'.
"Today as I dey cook free food for di vulnerable and homeless pipo for di street of Lagos like I dey always do, some uniform men come dia to harass me, bull me and take away di food wey I dey."
"Dem take away my cooking gas and evritin I bin dey use to make free food. My only offense na say I dey serve love for plate through my healthy meals," she write for Instagram.
She add say she no be chef she no dey 'cook to sell'
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post










