'Why I dey dance like Indians inside Kannywood movies' - Ali Ali Maidala

Wetin we call dis Video,
'Why I dey dance like Indians inside Kannywood movies' - Ali Ali Maidala

Ali Ali Maidala say im love for India songs na im make am dey dance like Indians inside Kannywood movies.

Di choreographer follow BBC Pidgin yan about wen im start to dey dance and wetin im don achieve wit im craft.

Maidala tok say im family bin no want make e be dancer but dem accept by di time im start to dey make money from am.

Di choreographer say im dey also teach pipo di Indian style of dancing.

E say despite say im dey famous, im dream na to go global.

Filmed by Monday Idara