'I wan be di best dancer in di world'

Wetin we call dis Video, Young Anabel, wey dey live for Port Harcourt, Nigeria don master her craft
'I wan be di best dancer in di world'

Anabel dance journey begin wen she fall in love wit di rhythm of music as she begin dey move her body to evri beat at di age of three.

Young Anabel, wey dey live for Port Harcourt, Nigeria, don master her craft as dancer - she dey inspired to be di best dancer in di world wen she become adult.

"I start to dey dance wen I dey three years old."

“I wan see myself to be di number one dancer in di whole wide world,” Anabel tell BBC Pidgin.

Six-year-old Anabel now, dey closer to her dream of becoming a world class dancer. She and her team, Exoduz dance crew win di De9jaspiritalenthunt competition for 2023.

Dis na big milestone for Anabel and her crew as dem be di first dance group wey win di national competition. Di dance group defeat two competitors during di final.

"As member of Exoduz Dance Crew, wetin ginger me be say dem sabi dance and I like di way dem dey dance and me I sabi dance," Anabel tok.

Skip Instagram post

Content is not available

View content on InstagramDe external site no concern BBC.

End of Instagram post

Anabel take di world by storm as she dey dance wit so much perfection evri week until she finally earn di winner title at di final despite being six years old.

Di audience dem dey jolli wenever she dey ontop stage as dem dey cheer am up to boost her confidence.

"Wen pipo dey clap for me, e dey ginger me more to dance more and to put energy," she tok

Whenever Anabel dance wit her crew members ontop stage, di audience dey pin dia eyes on am as she dey dance wit so much passion and joy to Afropop music wit her unique dance style and energy wey don make am become fans and celebrities favorite.

"Exoduz Dance Crew na wonderful dance crew and dem don change my life and dem don make me dance pass di way I bin dey dance before," she tok.

Exoduz Dance Crew

Wia dis foto come from, Exoduz Dance Crew/Instagram